Omo nothing anybody wan cap me, Person wey create that yeye thread no be Nigerian, na one of these mumu people outside wey just wan drag our leg come outside. Yes I know say we Nigerians Dey mumu sometimes, sometimes we Dey behave like say we no get sense, but baba, nobody go wan use him own hand comot bread for him own mouth, no matter how him mumu ripe reach. Random person just burst out with that kind username, Dey stir up agenda, people there dey claim to Dey naive say them no really know wetin Dey sup. Make everybody just Dey mumu themselves there…
I reason am too say no be Nigerian create that topic but how we want take know, make I tell you eh our pipo the miss yan sometimes, even sometimes wey I go outside our LB see wetin some of our pipo dey tok eh, dey thing dey pain me wella, see ba even if sey me I no dey convinced sey na our naija pesin write that thing eh, I go still wan tok am how e be me for mind, the pipo wey I dey see recently for our LB no pure for my eye, e come be like say dey bring some morons come full for we LB, I no no who I dey offend like this but e don do, baba no be say I no understand you but our own mumu don do too, our local board here dey make sense before but some new guys wey enter don spoil everything, e go good sey we dey advice anybody wey we bring e get why or make we kuku rest e do.