Oga @sexylizzy2813 you don Dey carry my mind Dey go the good old days and one of the greatest happiness be say I was privileged to be part of it and truly you don catch me for this one wey you say we run comot because me I been shake body small instead of me to get personal issues with person wey we Dey hustle together because I remember say na we been Dey hit for the local board back then and e been Dey really sweet, competitive and interesting but now, everybody blood just come Dey hot.
I hope they go try give pidgin language a chance make e deliver atleast na for all of us good
No be my fault becos if we no bring back those good old days wey make the local board dey like Local Board which storyline we wan give the newbies wey join us now? Nothing so we don see things wey go even give us mouth to say here na PIGIN arena but e come be like say as we dey use PIGIN post e dey cause problems and na why plenty of us comot, the shocking part be say e get some people wey dey use PIGIN post before but as soon as them ring bell nai all of them run leave PIGIN. E con do me like say me wey dey post with PIGIN no near school, I see myself as person wey no go school, honestly that time e worry me but I no allow am weigh me down, I remember when one of the iron lady for this Forum talk about thick skin, I rush go market buy am put for body na so I take over come all these things we face for our Local Board, nai make I still dey come here even if some people wan frustrate person, make I see how the matter go be like and again,
Welcome back to Our Local Board Obari.
Support PIGIN For Our Local Board...Thank you my chief as you open your two hand welcome me bad as I pray say your own no go even spoil.
I remember when Brainboss been Dey give out 10 merits weekly to highest posters for the board and trust me, the number of merits fit no big ooo but the competition was very healthy and the na Igeh been Dey compute those results for winners
I hope we go try Dey use more of pidgin for the local board rather than plain English and e even get time for the local board wey most times when I Dey write with pidgin, I Dey edit am because I Dey feel like I Dey use the wrong language for a particular thread.
I go commend you again @sexy for your consistency and how you take hold ground for this pidgin matter and I remember how I don see you several times for some kind banter with men with regards to this same pidgin matter.
This one you call me Chief abeg oh, the only chief I know here sabi himself full time and I respect that nigga well well and I been wan take that title but money no dey, Mr @Mbamegbu na man wey sabi and na only him dey give wetin d local board need, complete PIGIN, go type English full ground na if him no go call you to order, na the type we need to put things in place but as we sabi say for local board and this Forum plenty people no like show themselves for public space.
And my man Oba I go always welcome you becos na so you welcome me when I first join the Forum, you be the type wey dey always do him best to make things right but I notice say as time go far English chop your mouth and posting style 😂 e dey happen so nothing spoil, posting in PIGIN with a little bit of English good nothing spoil but where we wan use English rob cream na where e dey some how. When you talk about consistency we all need am and if I no learn from una wey be the people I come meet here I for no sabi road, na you and some other plenty people I go thank, una deserve hug no be the perfume oh, you know na.
I no go like to see plenty of us dey use fear to say the truth and na why e be say plenty of wetin we dey post dey enter dustbin because we no dey talk, we allow am slide, if this thing continue this local board will not be that local for our eyes again because we go leave am run for who wan inherit am but God no go gree.
Support PIGIN For Our Local Board...