|
GiftedMAN
|
 |
August 28, 2026, 01:10:13 PM |
|
one thing way dey confuse me sometimes na how come way be say even people way get sense about cryptocurrency dey still dey fall for crypto scam. no be only new people for cryptocurrency dey fall for scam, even people way done they for crypto business for long dey fall for scam too.
No be lies you talk this crypto scam na something wey dey affect both the newbies and the og's wey dey for the business but if you check well na most newbies dey fall for scam especially those newbies wey like free things and easy profit making investments. For the og's I think say na lack of good research dey make most of them enter that trap because them fit no do background checks when them come across new projects but after dem don put money na when dem go notice by then say na scam projects dem invest into. Some newbies na lack of information dey worry them as some of them dey like run to unknown people online for him na so Dem dey expose themselves to scammers wey go use that opportunity take advantage of them by having access to their wallet.
|
|
|
|
|
|
Bitcoin.com97
|
 |
August 28, 2026, 02:17:51 PM |
|
To dey smart no means say some kind mistake no fit sup for life ,e get waiting you fit don Sabi and your mind go tell you say ,you fit still get more of that ,with that you go say make you try out ,nah there you go come fall vitim ,so I no dey surprised if person way dey into the business fall for scam ,if you say greed too ,that one dey , greediness don make many fall for scam well well too,so crypto scam no be only for newbie,but for people way dey for the system,I know say so many things go cause am no be only this one way i think , and to dey smart no really guarantee say person no fit fall for scam .
|
|
|
|
|
B-BossMan
|
 |
August 28, 2026, 03:25:04 PM Last edit: August 28, 2026, 03:38:23 PM by B-BossMan |
|
To dey smart no means say some kind mistake no fit sup for life ,e get waiting you fit don Sabi and your mind go tell you say ,you fit still get more of that ,with that you go say make you try out ,nah there you go come fall vitim ,so I no dey surprised if person way dey into the business fall for scam ,if you say greed too ,that one dey , greediness don make many fall for scam well well too,so crypto scam no be only for newbie,but for people way dey for the system,I know say so many things go cause am no be only this one way i think , and to dey smart no really guarantee say person no fit fall for scam .
Na so na, everything happens for a reason, either na bad things or na good things. Somtimes sef if you too dey claim smartness na so so things go dey happen for u wey u no even expect for life, like the common mistakes many newbies dey wey you yourself go dey warn them about, and because of over sabi or claiming too much smartest don make you fall for victim, at times na just pray ooo, because eh E get many tactics and strategies wen scammers they always use, different format, na why once I just see any suspicious links or if I dey doubt something online, I no dwy even bother to know about am much, because the more you dey try know every aspect of the thing, the more you go get sink inside the thing and fall for traps. Forget about smartness, make we just they security conscious and dey vigilant, that is it.
|
|
|
|
|
Rockson1
|
 |
August 28, 2026, 04:56:52 PM |
|
No be lies you talk this crypto scam na something wey dey affect both the newbies and the og's wey dey for the business but if you check well na most newbies dey fall for scam especially those newbies wey like free things and easy profit making investments.
For the og's I think say na lack of good research dey make most of them enter that trap because them fit no do background checks when them come across new projects but after dem don put money na when dem go notice by then say na scam projects dem invest into.
Some newbies na lack of information dey worry them as some of them dey like run to unknown people online for him na so Dem dey expose themselves to scammers wey go use that opportunity take advantage of them by having access to their wallet.
Na true sey, na people wey just the enter crypto (newbies) na em crypto scammers the catch quick pass, but the matias be sey every oma de collect woto poros if dem no dey kiafful, no forget sey the Internet space no dey friendly, some niggas operate in different ways, so any pesin fit be victim, na to dey very watchful na em sure pass, make no person go junx, call em self og, except the Pesin don decide sey, em wan lose money. I no tok set wetin you talk about newbies as e concern dey matias na lie, but now eh, everi everi fit fall be maga, especially when you be pesin wet too like awoof, wetin I go advice be sey, make no body store their seeds online, and make we no go the talk to random pesin for social media about any crypto asset, make we no go give listening ear becos na wetin the make people fall for scam quick.
|
|
|
|
|
Inior
|
 |
August 28, 2026, 06:19:39 PM |
|
Levels dey to this scam thing o, even people wey get the knowledge fit still loose guard not because say them no dey make research but the actual thing be say some scammers get more insight pass some people wey dey invest in crypto, this is why emphasis always dey on keeping yourself updated because wetin you know no dey enough. A lot of scammers dey use very organized patterns and e go dey hard to tell if you lack some certain information. one tip wey I fit give anybody wey dey invest in crypto especially if them still dey the beginner or intermediate level, no try to rush your progress, always take am one step at a time
|
|
|
|
Mpamaegbu
Legendary

Activity: 3528
Merit: 1306
Crypto Casino with No KYC on routine deposits
|
 |
August 28, 2026, 06:33:09 PM |
|
So watin you think say be the main reason why people way get sense about cryptocurrency or done dey for crypto business for long, dey fall victim of scam, na greed dey cause am, FOMO, overconfidence, social pressure, watin dey really cause am?
To know book nor mean sey persin dey intelligent oh, shey u know dat wan ba? To dey into cryptos nor also mean sey persin dey street smart about wetin dey happen around dem, even for d same cryptos sef. To be able to catch scammers before dem hit, persin must get street smartness. E nor be about to get sense. To get sense and nor apply am, nor mean anything where scammers dem dey. Shey e nor dey surprise u wen u see learned men and women, some PhD holders dey go church where dem pastors dey tell dem wetin nor dey Bible, yet dem go dey there dey shout, "Yes Papa" to children wey dem fit born? Na dat lack of street smartness wey I dey talk about. E dey applicable to cryptos and every other faucet of life.
|
| | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | | | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | | ████████████████████████████ 100 FREE SPINS ████████████████████████████ | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | CLAIM BONUS |
|
|
|
|
Audrey Simmons
|
 |
August 28, 2026, 06:40:43 PM |
|
So watin you think say be the main reason why people way get sense about cryptocurrency or done dey for crypto business for long, dey fall victim of scam, na greed dey cause am, FOMO, overconfidence, social pressure, watin dey really cause am?
Na because say dem believe to already dey wise enough to control the situation, some victims go choose to play along until e happen say the scammer come sabi pull the move pass them, before them go realize, dey done fall victim to scam. Some too na out of negligence, as be say you know the right thing, why not do am at all cost, this na for mostly wallet security.
|
|
|
|
|
Nightwatchmare
|
 |
August 28, 2026, 08:04:05 PM |
|
For a smart person to fall into scam then the person no Dey smart again na.. wetin Dey worry the person na foolishness. Our people talk say one person no Dey sabi everything wey Deh for the whole world. If you Dey smart no really mean say you sabi everything for the world, e get where your smartness level go reach. Me I believe say smartness Dey different from to sabi something because ordinarily if person already know say this tin wey him wan go do na scam then the person no go gree put hand for the tin. But as e be say him no no say na scam be that na wetin make him go put hand for the tin. But the problem be say some people go see shit for day time finish then come match am for night, e get some people wey dem don scam before using the same format but them still no want get sense, because say them want make big money quickly dem go use because of greed fall for the same scam. That one na foolishness no be smartness again.
As you know say person no go sabi everything for the world you for no talk say na foolishness they worry smart person if in fall into scam because person way scam am in knowledge fit start from where in own knowledge ends. I completely agree say smartness they different from to sabi something because i don see people way sabi something but they no fit use am make money and i don also see people way they smart and they use their smartness make better money. But to fall for scam, me i think say na people way their source of money no they really enough to take care of them they always fall for scam even when they know say the thing them want put hand na scam because they want make extra money before the thing go fail.
|
|
██ ██ ██████ | R |
▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄ ████████████████ ▀▀▀▀█████▀▀▀█████ ████████▌███▐████ ▄▄▄▄█████▄▄▄█████ ████████████████ ▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀ | LLBIT | ██████ ██ ██ | ██████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██████ | ██████████████ THE #1 SOLANA CASINO
██████████████ | ██████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██████ | ████████████▄ ▀▀██████▀▀███ ██▄▄▀▀▄▄█████ █████████████ █████████████ ███▀█████████ ▀▄▄██████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ ████████████▀ | ████████████▄ ▀▀▀▀▀▀▀██████ █████████████ ▄████████████ ██▄██████████ ████▄████████ █████████████ █░▀▀█████████ ▀▀███████████ █████▄███████ ████▀▄▀██████ ▄▄▄▄▄▄▄██████ ████████████▀ | [ [ | 5,000+ GAMES INSTANT WITHDRAWALS | ][ ][ | HUGE REWARDS VIP PROGRAM | ] ] | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | ████████████████████████████████████████████████ PLAY NOW ████████████████████████████████████████████████ | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ |
|
|
|
|
Yeesha
|
 |
August 28, 2026, 08:30:42 PM |
|
To dey smart no means say some kind mistake no fit sup for life ,e get waiting you fit don Sabi and your mind go tell you say ,you fit still get more of that ,with that you go say make you try out ,nah there you go come fall vitim ,so I no dey surprised if person way dey into the business fall for scam ,if you say greed too ,that one dey , greediness don make many fall for scam well well too,so crypto scam no be only for newbie,but for people way dey for the system,I know say so many things go cause am no be only this one way i think , and to dey smart no really guarantee say person no fit fall for scam .
Correct, d thing bi say u go know say na scam oo, but sometimes you no go know wettin dey happen until dey scam u finish, na den u go realise am. Our problem na greediness, na him dey make even intelligent people fall for scam. Dat 419 people smart ooooooo, na style dem dey use deceive someone. After dey give person small amount of money, dem go demand huge amount of money from u, promising to return am to you in multiple ways, before u know greediness go fuel your journey and you go send them d money. Wettin I wan talk now must of us dey make that kind mistake ooo, we love to dey click anyhow links wey go fit land us for wahala.
|
|
|
|
Sandra_hakeem
Legendary

Activity: 1610
Merit: 1111
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
|
 |
August 28, 2026, 08:53:24 PM |
|
So watin you think say be the main reason why people way get sense about cryptocurrency or done dey for crypto business for long, dey fall victim of scam, na greed dey cause am, FOMO, overconfidence, social pressure, watin dey really cause am?
To know book nor mean sey persin dey intelligent oh, shey u know dat wan ba? To dey into cryptos nor also mean sey persin dey street smart about wetin dey happen around dem, even for d same cryptos sef. To be able to catch scammers before dem hit, persin must get street smartness. Him no understand say some people fit act very wise, like say na them wise pass taliman, but them go zuzu on top very small things because them dey gullible normally, na just say the smartness don enlighten them on how to dey spot out easy scams quickly, but not from a distance. Them fit don participate for the scam go far before them go begin dey see red flags sef. E nor be about to get sense. To get sense and nor apply am, nor mean anything where scammers dem dey. Shey e nor dey surprise u wen u see learned men and women, some PhD holders dey go church where dem pastors dey tell dem wetin nor dey Bible, yet dem go dey there dey shout, "Yes Papa" to children wey dem fit born? Na dat lack of street smartness wey I dey talk about. E dey applicable to cryptos and every other faucet of life.
That one na for people wey dey seek validation for everything wey them wan do. If another person no tell me say na the right path then wan follow so, them no dey certain to continue. At some point, the person go lord them--- anything wey dem talk, good or bad, na wetin Dem go do.
|
| ..Stake.com.. | | | ▄████████████████████████████████████▄ ██ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ██ ▄████▄ ██ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ██████████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ██ ██████ ██ ██████████ ██ ██ ██████████ ██ ▀██▀ ██ ██ ██ ██████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██████ ██ █████ ███ ██████ ██ ████▄ ██ ██ █████ ███ ████ ████ █████ ███ ████████ ██ ████ ████ ██████████ ████ ████ ████▀ ██ ██████████ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ██████████ ██ ██ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ██ ▀█████████▀ ▄████████████▄ ▀█████████▀ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄███ ██ ██ ███▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ██████████████████████████████████████████ | | | | | | ▄▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▄ █ ▄▀▄ █▀▀█▀▄▄ █ █▀█ █ ▐ ▐▌ █ ▄██▄ █ ▌ █ █ ▄██████▄ █ ▌ ▐▌ █ ██████████ █ ▐ █ █ ▐██████████▌ █ ▐ ▐▌ █ ▀▀██████▀▀ █ ▌ █ █ ▄▄▄██▄▄▄ █ ▌▐▌ █ █▐ █ █ █▐▐▌ █ █▐█ ▀▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▀█ | | | | | | ▄▄█████████▄▄ ▄██▀▀▀▀█████▀▀▀▀██▄ ▄█▀ ▐█▌ ▀█▄ ██ ▐█▌ ██ ████▄ ▄█████▄ ▄████ ████████▄███████████▄████████ ███▀ █████████████ ▀███ ██ ███████████ ██ ▀█▄ █████████ ▄█▀ ▀█▄ ▄██▀▀▀▀▀▀▀██▄ ▄▄▄█▀ ▀███████ ███████▀ ▀█████▄ ▄█████▀ ▀▀▀███▄▄▄███▀▀▀ | | | ..PLAY NOW.. |
|
|
|
|
Stable090
|
 |
August 28, 2026, 09:25:38 PM |
|
one thing way dey confuse me sometimes na how come way be say even people way get sense about cryptocurrency dey still dey fall for crypto scam. no be only new people for cryptocurrency dey fall for scam, even people way done they for crypto business for long dey fall for scam too.
Na everybody fit fall for crypto scam, but scammers Dey always find newbies, because dem know say na newbies Dey easy to scam pass. All dis cheap strategies wey we Dey see, newbies still Dey fall for am, but people wey don Dey d space for some time no go fall for all those weak strategies wey dem Dey use. Some people wey don Dey crypto space for some time Dey wan take risk, and na Wetin I feel say Dey affect them be that. Some scam strategy are always so real, so even if u get sense, u no go fit detect easily say na scam strategy e be. But all dis weak strategies wey Dey, people wey don Dey d space for some time no go fall for am now.
|
|
|
|
|
Agbamoni
|
 |
August 28, 2026, 09:26:48 PM |
|
So watin you think say be the main reason why people way get sense about cryptocurrency or done dey for crypto business for long, dey fall victim of scam, na greed dey cause am, FOMO, overconfidence, social pressure, watin dey really cause am?
Greed follow but e no fit be d only reason wy people way sabi weting crypto be dey still fall for the scam everyday. Other factors follow. FOMO na one big factor way dey make sabinus them for crypto still they fall for all these mistake even after wetin dey done know. Emotional control na nother big reason. Inside their mind they know the right thing to do oo, but they go still they do the other wrong thing because their emotions they take full control of them.
|
| ..Stake.com.. | | | ▄████████████████████████████████████▄ ██ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ██ ▄████▄ ██ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ██████████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ██ ██████ ██ ██████████ ██ ██ ██████████ ██ ▀██▀ ██ ██ ██ ██████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██████ ██ █████ ███ ██████ ██ ████▄ ██ ██ █████ ███ ████ ████ █████ ███ ████████ ██ ████ ████ ██████████ ████ ████ ████▀ ██ ██████████ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ██████████ ██ ██ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ██ ▀█████████▀ ▄████████████▄ ▀█████████▀ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄███ ██ ██ ███▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ██████████████████████████████████████████ | | | | | | ▄▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▄ █ ▄▀▄ █▀▀█▀▄▄ █ █▀█ █ ▐ ▐▌ █ ▄██▄ █ ▌ █ █ ▄██████▄ █ ▌ ▐▌ █ ██████████ █ ▐ █ █ ▐██████████▌ █ ▐ ▐▌ █ ▀▀██████▀▀ █ ▌ █ █ ▄▄▄██▄▄▄ █ ▌▐▌ █ █▐ █ █ █▐▐▌ █ █▐█ ▀▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▀█ | | | | | | ▄▄█████████▄▄ ▄██▀▀▀▀█████▀▀▀▀██▄ ▄█▀ ▐█▌ ▀█▄ ██ ▐█▌ ██ ████▄ ▄█████▄ ▄████ ████████▄███████████▄████████ ███▀ █████████████ ▀███ ██ ███████████ ██ ▀█▄ █████████ ▄█▀ ▀█▄ ▄██▀▀▀▀▀▀▀██▄ ▄▄▄█▀ ▀███████ ███████▀ ▀█████▄ ▄█████▀ ▀▀▀███▄▄▄███▀▀▀ | | | ..PLAY NOW.. |
|
|
|
|
Obari
|
 |
August 28, 2026, 10:23:40 PM |
|
Greed na one major factor wey I believe Dey make people fall for these scams and greed no Dey pay attention to wether you be new person or you be old person for the system in as much as greed don build up at some point for person mind, e go dey very easy for that kind person to fall victim to scam and make you no also forget say these scams Dey come in different forms and seasons and being aware of bitcoin and cryptocurrency in general no mean say we don big pass to collect whining so make we just Dey careful and hope we no fall victim of such thing.
|
| | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | | | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | | ████████████████████████████ 100 FREE SPINS ████████████████████████████ | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | | ████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ████ | CLAIM BONUS |
|
|
|
|
Dzwaafu11
|
 |
August 28, 2026, 10:38:07 PM |
|
one thing way dey confuse me sometimes na how come way be say even people way get sense about cryptocurrency dey still dey fall for crypto scam. no be only new people for cryptocurrency dey fall for scam, even people way done they for crypto business for long dey fall for scam too. One wey you self supoose to understand be say, person get sense or person know about something no mean they no go scam am anything fit happen, if they scam person you go first surprised how come say they scam for wetin him talk say him know, but you see this stammer na knowledge and prayer be their problem, you fit know about something make them still scam you for that thing wey you de talk say know. You fit talk say e de easy to scam newbie pass person wey they game before, na why I de tell you say make person just be knowledgeable before they do anything for the space I just hope they will make sure they don't rush things because some people na that rush they make them enter one chance.
|
|
|
|
|
|
| R |
▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄ ████████████████ ▀▀▀▀█████▀▀▀█████ ████████▌███▐████ ▄▄▄▄█████▄▄▄█████ ████████████████ ▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀ | LLBIT | | | 4,000+ GAMES███████████████████ ██████████▀▄▀▀▀████ ████████▀▄▀██░░░███ ██████▀▄███▄▀█▄▄▄██ ███▀▀▀▀▀▀█▀▀▀▀▀▀███ ██░░░░░░░░█░░░░░░██ ██▄░░░░░░░█░░░░░▄██ ███▄░░░░▄█▄▄▄▄▄████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ | █████████ ▀████████ ░░▀██████ ░░░░▀████ ░░░░░░███ ▄░░░░░███ ▀█▄▄▄████ ░░▀▀█████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀ | █████████ ░░░▀▀████ ██▄▄▀░███ █░░█▄░░██ ░████▀▀██ █░░█▀░░██ ██▀▀▄░███ ░░░▄▄████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀ |
| | | | | | | | | ▄▄████▄▄ ▀█▀▄▀▀▄▀█▀ ▄▄░░▄█░██░█▄░░▄▄ ▄▄█░▄▀█░▀█▄▄█▀░█▀▄░█▄▄ ▀▄█░███▄█▄▄█▄███░█▄▀ ▀▀█░░░▄▄▄▄░░░█▀▀ █░░██████░░█ █░░░░▀▀░░░░█ █▀▄▀▄▀▄▀▄▀▄█ ▄░█████▀▀█████░▄ ▄███████░██░███████▄ ▀▀██████▄▄██████▀▀ ▀▀████████▀▀ | . ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ░▀▄░▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄░▄▀ ███▀▄▀█████████████████▀▄▀ █████▀▄░▄▄▄▄▄███░▄▄▄▄▄▄▀ ███████▀▄▀██████░█▄▄▄▄▄▄▄▄ █████████▀▄▄░███▄▄▄▄▄▄░▄▀ ████████████░███████▀▄▀ ████████████░██▀▄▄▄▄▀ ████████████░▀▄▀ ████████████▄▀ ███████████▀ | ▄▄███████▄▄ ▄████▀▀▀▀▀▀▀████▄ ▄███▀▄▄███████▄▄▀███▄ ▄██▀▄█▀▀▀█████▀▀▀█▄▀██▄ ▄██▀▄███░░░▀████░███▄▀██▄ ███░████░░░░░▀██░████░███ ███░████░█▄░░░░▀░████░███ ███░████░███▄░░░░████░███ ▀██▄▀███░█████▄░░███▀▄██▀ ▀██▄▀█▄▄▄██████▄██▀▄██▀ ▀███▄▀▀███████▀▀▄███▀ ▀████▄▄▄▄▄▄▄████▀ ▀▀███████▀▀ | | OFFICIAL PARTNERSHIP SOUTHAMPTON FC FAZE CLAN SSC NAPOLI |
|
|
|
|
Different patterns
|
 |
August 29, 2026, 10:07:36 AM |
|
My thinking be say even if person get knowledge about cryptocurrency not really mean they no go fall for scam, even if person wey Dey cropto for long time, can still fall for victim when emotions take over. At times nah overconfidence or lemme say greed make some people fall for scam. Even to make a quick profit on a fast way can also make people to overlook warning signs, and scammers you see, they think behind what people think, so any time they wn scam person, they make it trustworthy and real, it left for you to play your smartness. My idea to contribute be say, make person at least have knowledge about anything they want to do especially in crypto space I think that can reduce the risk, and always verify this befor putting your funds inside.
|
|
|
|
|
Mr_Brilliant$
|
 |
August 29, 2026, 11:52:42 AM |
|
The thing be say as per person way done know all about scams go come dey confident say he no go fit happen to am. Na when the scam go fit meet am, just because he dey too overconfident for himself. That kind thing fit cause am not to recognise scam way be say him dey familiar with.
And another angle be say being familiar with something way be say you dey do all the time go come make you no take note of watin be scam for your eye. Scammers done dey wise to the extent way dem no dey try play with person intelligent, all dem go do be say na to time you at the right time and you go fall yakata.
|
|
|
|
CryptoHeadlineNews
Legendary

Activity: 1792
Merit: 1041
Want to run a Signature Campaign? Contac: @Hhampuz
|
 |
August 29, 2026, 12:03:44 PM |
|
one thing way dey confuse me sometimes na how come way be say even people way get sense about cryptocurrency dey still dey fall for crypto scam. no be only new people for cryptocurrency dey fall for scam, even people way done they for crypto business for long dey fall for scam too. well one thing be say all this scams na people way study why people dey think certain way, feel certain things and behave the way them dey behave. so all this scams dey use FOMO, greed, urgency, fake fake social proof, all this celebrity promotion and endorsement and all this fake fake promises of big gain, go make people act before dem go even reason to investigate. some times fake confirmation say something dey work na one thing way dey also make some people fall victim. So watin you think say be the main reason why people way get sense about cryptocurrency or done dey for crypto business for long, dey fall victim of scam, na greed dey cause am, FOMO, overconfidence, social pressure, watin dey really cause am? English no dey permitted. no write with English for here.
Na true talk you just yan so for this thread, and eh dey true say greed and most especially the Fear Of Missing Out (FOMO) na two major factors wey dey lure people who dey call themselves experience crypto users into falling victim to crypto scam. And in cases like this, i just think say until people get the mentality say genuine go offer a return of investment wey look too good to be true with unrealistic rewards. Or most especially to just avoid anything online wey go require you to first put in money before you make money. Because most genuine ways of making money online now go either require you to either execute your skills, sell something or provide digital value in other to get money in return.
|
| █▄ | R |
▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄ ████████████████ ▀▀▀▀█████▀▀▀█████ ████████▌███▐████ ▄▄▄▄█████▄▄▄█████ ████████████████ ▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀ | LLBIT | ▀█ | THE #1 SOLANA CASINO | ████████████▄ ▀▀██████▀▀███ ██▄▄▀▀▄▄█████ █████████████ █████████████ ███▀█████████ ▀▄▄██████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ ████████████▀ | ████████████▄ ▀▀▀▀▀▀▀██████ █████████████ ▄████████████ ██▄██████████ ████▄████████ █████████████ █░▀▀█████████ ▀▀███████████ █████▄███████ ████▀▄▀██████ ▄▄▄▄▄▄▄██████ ████████████▀ | ........5,000+........ GAMES ......INSTANT...... WITHDRAWALS | ..........HUGE.......... REWARDS ............VIP............ PROGRAM | . PLAY NOW |
|
|
|
devouring-DARKNESS
Jr. Member

Activity: 61
Merit: 2
|
 |
August 29, 2026, 12:30:08 PM |
|
Scam na part of human nature and no be only crypto scam dey even fiat scam too dey. As long as na money matters, scammers must to find way to achieve people funds.
E go good say make we dey vigilant and dey use to all these crypto scam methods both old and new so that you go fit safeguard yourself from am and also tell other people around you wey dey the cryptospace.
On how you check out some scam stories you go notice day na some people dey make scammers continue to do run am, crypto own dey some how because you gats dey active online for that one to happen but wetin dey really hit our people well na this Ponzi scheme something, e don bad ooh, I follow my man go hospital to collect test results, some staffs for there come dey complain about how them been put money for one Ponzi like that, some of them been don even collect money from there already but the site come bring one upgrade like that but you gats put more money to upgrade, na so these people take loss money to this Ponzi scheme ooo. Make we dey watch ourselves for these kind things, some people dey collect money sha, but people way dey lose money to the thing dey plenty pass people way pack from am.
|
|
|
|
|
|
Marvelockg
|
 |
August 29, 2026, 01:09:13 PM |
|
So watin you think say be the main reason why people way get sense about cryptocurrency or done dey for crypto business for long, dey fall victim of scam, na greed dey cause am, FOMO, overconfidence, social pressure, watin dey really cause am?
E get one bad thing when over familiarity de do to person and if you no take time, the way you take de too familiar with things fit be the main reason why you go experience something bad from that thing. Cryptocurrency scam na something when as you don tey for the game, you supposed de used to some of these things but some of us de always assume say because we sabi how e de be say we no fit fall victim. Being cautious no follow for who don tey for the Industry or not. Same way e de neccesary make newbie de cautious, na the same way e de neccesary make the older ones de cautious. Experience no de bail person out fell where negligence carry person put.
|
|
|
|
|
Nheer
|
 |
August 29, 2026, 02:16:22 PM |
|
So watin you think say be the main reason why people way get sense about cryptocurrency or done dey for crypto business for long, dey fall victim of scam, na greed dey cause am, FOMO, overconfidence, social pressure, watin dey really cause am?
Greed follow but e no fit be d only reason wy people way sabi weting crypto be dey still fall for the scam everyday. Other factors follow. FOMO na one big factor way dey make sabinus them for crypto still they fall for all these mistake even after wetin dey done know. Emotional control na nother big reason. Inside their mind they know the right thing to do oo, but they go still they do the other wrong thing because their emotions they take full control of them. Omo this cryptocurrency thing or anything wey involve money get different reason why people dey fall for scam even though Dem Sabi how the thing dey be and different people get wetin Dem draw them to am. And these scammers dey use strategic moves to lure people psychologically na why even people wey Sabi dey fall victim too. Of course Fomo and Greed dey play a huge part for why people dey fall for scam but no be the only reason. Some people own na over confidence and over Sabi, Dem dey feel like nothing fit do them, no scam fit catch them and for everything over Sabi no good. You don talk the whole thing already, na emotional control be the koko. If you go Sabi control your emotions e go reduce your exposure to scam. Knowledge is one thing but emotions fit easily influence your decision and at the end na you dey make d final decision.