Guy you fit tell me the language wey we suppose dey use for naija local board on a norma? I dey very sure say you know wetin local board represent, Which one come be division again? I no wan just go further the talk about this matter, make I tell you, I no think sey e get any naija pesin wey no sabi speak pidgin, make nobody whyn you, any pesin wey you see wey talk like that make you know sey person dey either lie or em get wetin em dey hide, i go fit accept sey make we give peace chance which na the right thing, any pesin wey no no pidgin make Dem go learn, na wetin dey know is for be that.
Bro if you know me in person, you suppose know say I be that type of person wey no dy like drama or arguing with person, so as I make my point on how I feel, if you no accept am, no wahala because we dy entitled to our own different opinion.
I fit agree with you say no Nigerian wey no sabi speak pidgin for south and western part of Nigeria, but in the north, you go discover say many people there no sabi English, talkless of pidgin. Wether you believe me or not, e no change anything because I dy talk out of experience, since business don carry me go there plenty times, and I don stay for kano state for one plus, so I dey sure for wetin I dy talk.