* Use a clean phone: If you are commuting to a place that is orobe to these stop and search, it is advisable to use a burner phone. You can swap your sims and use a phone that have nothing related to crypto in it. You can even use a button phone that cannot assess the internet.
Wetin you don explain here na typical case of police Harassment wey almost every young good looking Nigerian dey very prone to experience, and e dey very bad say d thing na no get selection, dem fit do am to every and anybody, dem no dey look say weda you be your hand clean or you dey run illegal, once dem see say you nice up, dem go wan dey on your mata and so, e dey always beta say make you prevent them than to say you go some dey try to want to defend yourself when dem don grab you. one bad thing with those pipo be say e no get as you clean reach, once dem grab you, dem go see one spot wey be say dem go use enter you, so e always better say make you dey avoid dem.
For all the steps wey you mention, dis using of clean Phone na one very effective one why be say me i really agree to, and make e no be say you go come do am like a very obvious disguise, if dem see you with only torch light phone, dem go believe say you get something wey you dey hide somewhere, you fit dey on another Android phone wey clean and den your transaction Phone, especially those wey dey trade P2P as hustle, you go always dey keep dat one for house, when you dey comot, carry d clean Phone since na their first point of approach to checking you be dat. another thing na say if the waka no necessary, avoid am, no be every time you go dey comot, sometimes stay house make you enjoy the rent wey you pay for the house.