
Yes! i said what i said cause what sort of a joke is this, what do these evil regime take us for, idiots? Tinubu and his team are just joking with Nigerians. In our local pidgin slangs "this one na see finish". To them, the citizens can't do anything cause they're immune to accountability and justice, so they can do whatever they like and get away with it.
Election don near now, na things like dis na him we go Dey see, all this politicians go come turn themselves to Mumu, imagine wetin person father Dey do on media, him no even get shame.
For my area wey we go do days and we no go get light, no be say d light get fault, but Dey no go just carry am come, and no be my area alone, na him dis man say things don block for freezer. As tinubu government don fail, and they have nothing to use and campaign, na lie remain wey dem go Dey lie give us now. For d state wey I Dey, I feel say light condition even worst self, and we paying higher than what we pay before.
Nothing wey all dis people go tell me wey go even surprise me again, person wey I go vote for don Dey my mind already, anything wey dem like make dem talk, even if dem like make dem turn say transfers don Dey blow because light to much, I no go still vote for them.