Bitcoin Forensics Competition | part 2"Evidence dey for blockchain. Na the details go show you the truth."
Wetin Be Bitcoin Escape Room part 2?Na the second part of my
Bitcoin educational puzzle tori .
E no be like For part 1, wey we focus on Bitcoin origin, basic things wey concern am, and history. this second part go focus on practical check check and you go think well well.
You go observe evidence, understand Bitcoin data, solve puzzles wey connect together and come explain how you take reach your final answer.
You no need to be Bitcoin developer. But if you be busy body, sabi reason things carefully, and dey pay attention to details, e go help you well.
watin dey for reward (Dem go pay for
BTC)
🥇 1st Place:
$50🥈 2nd Place:
$25🥉 3rd Place:
$15
Rules• Alt accounts no dey allowed, and go report anybody wey use am.
• You must don earn at least 5 merits for inside the last 120 days.
• Season 2 get
6 puzzle rooms, and you must escape from all of dem before you fit win.
• No just drop answer, show how you take reason am. Answers wey explain things well go get more value pass the one wey reply with one word.
• Discussion dey allowed, but every body wey participate must submit e own answer.
• If any room too difficult, hints fit come out later.
• Dem go choose winners based on the overall quality of their answers for inside the six rooms, no be by who first finish.
• Answers wey get small effort, na copy and paste, or na Ai dem take run am go dey disqualify.
• watin come dey important pass be say, make you enjoy yourself and have fun with the challenge!
How you go take ParticipateNo special format dey. Just solve all the rooms and climb the leaderboard go up.
The first three people wey escape go collect rewards, but dem fit add more rewards if more people join participate.
The tori
You think say your journey don end after you escape from Satoshi's Vault.
You dey wrong.
Many years later, one strange message show for your side:
MATTER #002: THE BLOCK WEY DEY MISS
Dem report say one transaction don disappear.
One wallet balance no dey make sense
Evidence from one block no dey follow road.
Two different source no gree conclude for wetin happen.
Somebody dey hide one important matter
Na your work to find am.
Dem don give you access to different transaction records, block data, technical clues, and witness reports.
Some of the evidence dey correct. Some fit no complete. And some other matter fit big pass watin dem first be like.
Six rooms dey between you and the truth.
D’ Rooms
Room 1 - The transaction wey disappear
Check one payment wey dey miss and find out wetin the evidence wey dey really prove.
--------------------------------------------------------------------------------
Room 2 - The Wallet Wey No make sense
Try re-arrange how the money take move and find watin dey strange about the wallet balance.
--------------------------------------------------------------------------------
Room 3 - The Block wey dem forge
Check data wey dey the block and find watin no allign for inside inside the evidence.
--------------------------------------------------------------------------------
Room 4 - The Trap wey get Fee
Check different transactions wey dey compete with each other and find out why their chances of confirmation no be the same.
--------------------------------------------------------------------------------
Room 5 - The Two places wey truth dey
Settle the matter wey dey between two different place wey bitcoin data dey.
--------------------------------------------------------------------------------
Room 6 - The last thing to come do
Put everything together and talk watin really happen.

When we go take dey drop postTo make am dey interesting,
dem go drop each room as a separate post inside the thread.| Link for the post | watin dey | how e dey now |
| Room 1 | The Transaction wey disappear | dem don escape am |
| Room 2 | The wallet wey e Balance No make sense | E go dey active till Nov 03rd 2026 |
| Room 3 | The Block Wey Dem Forge | Go active Nov 03rd, 2026 |
| Room 4 | The Trap wey get Fee | Dem never decide date yet |
| Room 5 | The Two places wey truth dey | Dem never decide date yet |
| Room 6 | The Last Thing to Come Do | Dem never decide date yet |
People wey dey leadWe go update the people wey dey lead after dem finish each room.
#The main idea no be just to escape. Na to show say you really understand Bitcoin.
Last MessageEvery transaction dey leave evidence.
Every block dey tell e own story.
But you must understand the evidence well.
You fit separate better thing from watin you think, talk wetin happen, and open the truth wey dey behind the block wey dey miss?
The game go start soon.
Make you dey watch out for Room 1.
Good luck to everybody wey dey participate!
na AOBT na run dis Translation by Dem self