Bitcoin Forum
May 11, 2024, 07:07:16 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
  Home Help Search Login Register More  
  Show Posts
Pages: [1] 2 »
1  Local / Nigeria (Naija) / Reason why crypto network dust traditional banks on: May 10, 2024, 02:26:14 PM
Some times, I dey forget how stressful to go bank be, especially when one or two don sup with your bank account. Based on say e don Tay wey I go bank or even get any issues with my account as e be say many minor transactions Na with all microfinance Bank Naim I dey use take dey run am. However the cashless period wey been happen before this time last year teach many people especially marketers and those small chops to dey accept transaction if not dem no go sell anything and perechable good go just dey spoil for their hand anyhow. That event really make am clear to us say, Nigerian dey very ready to adapt to any situation wey dem find their sef. Though many people still dey find am very difficult to understand some certain things but even both literate and illiterate people  don already Sabi cashless business with only transfer.

Though, majority of the crypto currency dey volatile in the sense that e no go too good for day to day business people as e fit make them run into loss after selling their goods finish, for instance now wey Bitcoin dey on price correction. But that Na why stable coins like USDT tether  dey, for this kind of purpose. The USD Na currency wey dey very difficult to fluctuate with high volatile Na why most traders dey use USD stable coins before and after dem buy or sell their coin. USDT get a very big advantage  of liquidity, Na why dem go be one of the best options for day to day business. But when we dey talk about large transaction business, Bitcoin Na I recommend.

Today I been dey pass one bank, Na there I see how some person stand dey wait for ATM machine, I come dey jealous El Salvador. Assuming say our government see the importance of crypto currency before them dey waist all this precious time to fight against am e for make our lives much easier and secured.



I don hear of cases where by after person withdraw from bank or ATM finish as e dey go em destination, armed robbers go just ambush am collect everything for em hand because of exposure wey e don place emself for the bank. But when it comes to crypto currency, una fit dey house do the transaction wey no body go dey aware of sef.
2  Local / Nigeria (Naija) / the decline in price of bitcoin on: May 01, 2024, 05:22:24 PM
actually na normal thing say after bitcoin halving we go come experience the price correction wey go make the price of bitcoin waka come down, just like how e come down after bitcoin reach the previous ATH of $68k. so normally the price of bitcoin fit go down well well but person wey know em left and right know say bitcoin go still rise again because after the price correction na better pump in price naim we go see. the news and some social media talk dem fit present the matter in a scary way but make una no panic especially the newbies, if your aim na to invest for long term then you no suppose get issue with this changes because every great story start from somewhere and if to say some of those big holders quit them for no dey where dem dey today. i no too like the idea of selling bitcoin to buy altcoin this period because na now we go see many of those altcoins turn to shitcoins, and since bitcoin go experience some dip why not channel more fund to buy at a cheaper rate so that when the price pump again you go get better profit for hand?

3  Local / Nigeria (Naija) / New scam alert BEWARE!! on: April 17, 2024, 02:38:52 AM
My people today I carry one update about scam wey sup for my eye come board today, and na new scam wey I just dey hear of for the first time, though the scammer was not successful but I still feel like to share so that we go dey very careful.

Some days ago I been wan buy phone from one of my neighbor, but e come tell me say make I wait make em new phone come before e release em old one,  naim I go back house with my money, after some days e come call me say make I go meet am for car park say the person wey dey bring em new phone dey come. Naim I go reach there as my neighbor come, e come tell me to transfer the money for am, without  delay naim I run am, thinking the em own selling dey the park there with us. Just for my guy to start to make call make the buyer send am the waybill code. Na this guy been wan send the em seller money for the guy to release the code. I come tell am to wait first, come ask am weda e trust the guy, e say e no even know am, I come suggest say make we ask the girls wey dey work there weda any phone delivery arrive so that we go dey sure say e don really come. Omor naim them tell us say dem scam person like that last week. Na there my body take weak, because that my guy for send my money join and e for come dey give me excuse.

One thing wey make this scam look real na the fact say the scammer send this guy message say na the waybill code message from the company but e come remove the actual code say unless the guy make payments before e go give am In full. Anyway my guy send me back my money after everything. But those wey like to cart phone or things online wey no be trusted platforms like jumia make una dey very careful, because this my guy, na for Facebook e take jam this seller and them talk for phone well but the guy intent na to scam am. So abeg if possible conduct physical business, so that if problem sup you know the person office already.

Abeg make una dey careful out there oo.
4  Local / Nigeria (Naija) / Newbies make una stop those off topic posts ASAP on: January 22, 2024, 10:09:14 PM
I know say post like this been don dey exist, forgive me, but this one too pain me to express my thoughts for old thread.

Newbie abeg I use God take beg una, make una try dey increase the quality of post. This forum no be where you go just wake up from sleep then anything wey you jam for social media you go carry am come dey talk for board. With the little time wey I don dey this forum and this board to be precise, I know how many of our boss at the top they work effortlessly to try make the local board for dey better and outstanding. But all these una off topic post Dem wey no get head don dey too much. Last year we deliberate on this matter, e come be like say the off topic  come reduce but now e don dey come up again.

Make I clear una say, as this our board be first 4 for the entire local boards na so eye Dem dey enter our body, to observe wattin dey happen. And when Dem see say na rubbish post plenty pass the main Bitcoin post, e go come be like say we no serious and we don they compromise. Off topic post get level, e get how you go create off topic but e go dey helpful for us as members of the forum or for our normal lives outside the forum. And e get some kind off topic wey go come even bring Bitcoin discussion for the thread later on, all those na creativity you go take do am. I no go lie you be like we go go back to the time wey Dem been dey report off topic post wey Dem go move to achieve oo. At least that go help our reputation.

Another one again na when we go see people dey go talk rubbish for out side board, guy afa make una use una head pan. Which one go dey go talk like say na Nigeria own naim bad pass for this life, if you wan blab the country come talk for where men go understand come relate with you, no be to dey go sell your own self for outside local board just because you wan try impress outsiders. Omor una wey dey do this thing dey fuck up big time. Una better repent oo, e no good. Why u no use pidgin talk am for local board instead of to dey betray us, they back stab us.
5  Local / Nigeria (Naija) / Buy bitcoin before the halving on: November 21, 2023, 08:26:02 AM
Good day my country people, compliment of the season. I carry one ogbonga advise come board today to share with my fellow bitcoiners. Normally we know how things hard generally no be only for our country but na for everywhere, and to even see food chop sef na by the grace of God. But I still gat advise say make we no fail to remember or forget say next year na the halving event go take place, and based on history the halving dey prove to boost the price of bitcoin, and the sweet part na be say even for those wey dem just like to do trading and not long term holding, the halving still dey bless dem. So my advise na be say make we no fail to buy bitcoin before the halving so that, by the end of next year we go dey guaranteed of say small thing add for our bitcoin investment and anything wey you like to do with am na your choice, but e for still good make we continue to hold for long term.

Just as I been talk before, the country hard, the country hard, but that one no mean say make we sitdown look this opportunity pass our eyes, normally Bitcoin no be do or die but for those wey fit make this sacrifice, I believe say we no go regret am most especially for those wey fit do small long term holding, like from now until January of 2025. Also as we dey hold for this period make we no let the happiness of the season allow us to loose focus to sell our precious coin any how oo, and make we no still keep our private key and seed phrase any how, because if you keep am anyhow or you fail to backup, your coins go loss for good.

This advise na mostly for the newbies, please be carefully who you tell about your bitcoin investment or holding.
6  Local / Nigeria (Naija) / Too much transaction fee on: November 14, 2023, 04:08:30 PM
Good day my fellow bitcoiners, all protocols observed. This few days I don do some series of transaction wey make me come dey wonder weda na all segwit wallet naim dey collect high fees for transaction abi na just the one wey I dey use, because na electrum wallet naim I use and the kind of transaction fee wey those people dey take charge my transaction nor dey nice at all, dem dey collect like 10% of the money wey I wan transact and this kind of thing dey short my money well well, naim make I say make I bring this problem come board weda my boss dem fit give me recommendations or direct me to any wallet wey nor dey too take much for transaction fee.
7  Local / Nigeria (Naija) / Useful sites for bitcoiners/crypto users on: October 23, 2023, 01:34:10 PM
Greetings my people, I say make I share some useful links to site wey fit help us as bitcoiners and generally crypto as a whole, update wey fit help your brother, dem nor dey hide am so I wan use this opportunity take beg us, if u get update wey you need share abeg no hesitate to share am. Some the links I go provide na links to site wey dey crypto related and dem get useful information wey fit boost our knowledge or add to am.

1. The Bitcoin Hole for software wallet: this one na I like pass because e go help us make the right decision to choose software wallet wey go dey to our favour. The actual work of this site na to compare 17 software wallet so that we go know the one wey we fit use, and this site they compare some features like the year wey dem launch the software, if the software wallet dey use lighting network, if the software wallet they allow to use multiple wallet at the same time, seed phrase, if the software wallet na open source or not, etc.

:
2. The Bitcoin Hole for Hardware wallet: this na almost thesame as the first one just that this one na hardware wallets e dey compare, and the most interesting thing na be say all the wallet dem u go fit use dem take hold BTC and their price tag also dey for there. And some things wey dem put to take compare the wallet them na launch year, stores to buy, years warranty, the weight and size of the hardware wallets, the kind of material wey dem use take produce am, if the hardware wallets na water proof or not, if na touch scream or not, charging type, etc.

3. BitcoinTimechainstart: this site gather many information about Bitcoin and you fit even recommend am to newbies make dem for use take understand basic of bitcoin, this site contain things like Current bitcoin price, latest block height, the remaining days to having event, Hash rate in 7days, the latest block mined, bitcoin price and hash rate graph, next mining difficulty adjustment, Bitcoin market cap, amount of bitcoin transaction up to three years, some Bitcoin FAQ and useful resources for study including wallet types, etc.

4. Github.com: this one if not all, many of us know about this one, na place for software developers, and for this place u fit get enough open source codes for your programming in regards to crypto, and na  also good learning environment not for beginners alone but also for advanced persons inside the crypto world. If you study for this sites you go chance to understand technical aspect of bitcoin, block chain , wallets, etc

5. Blockchain.com:this na almost thesame thing with the bitcoin timechainstart but this one get other information about some altcoins, and e they show all transaction wey dey for the block chain, the most interesting thing about this one na be say u go fit input any public wallet address and e go show you all transaction from that wallet.

Any additional opinion from you guy is fully accepted as it might help a brother here, and just as I said earlier "abeg make we dey hide update"
8  Local / Nigeria (Naija) / CBN lifts Forex(FX) restriction on 43 items on: October 16, 2023, 09:34:43 AM
My people una don hear??, say CBN don lift foreign exchange restriction for 43 items for importer and buyers for the exchange market. This one shock me oo, since our baba been order the restriction I think say dem no go reason am again, no be say the restriction wey dem put na for the items oo, na just for the exchange of foreign currency so that e go hard some how for importer, but dem been nor no say e go back fire big time naim be one of the Major reasons why the price of imported good skyrocket so like this na we dey expect the price of these items to come down.

Quote

The items were Rice, Cement, Margarine, Palm kernel, Palm oil products, Vegetable oils, Meat and processed meat products, Vegetables and processed vegetable products; Poultry and processed poultry products; Tinned fish in sauce (Geisha)/sardine; Cold rolled steel sheets; Galvanized steel sheets; Wheelbarrows; Head pans; Metal boxes and containers; Enamelware; Steel drums; Steel pipes, Wire rods (deformed and not deformed); Iron rods; Reinforcing bars; Wire mesh; Steel nails; Security and razor fencing and poles; Wood particle boards and panels; Wood fiberboards and panels; Plywood boards and panels; Wooden doors; Toothpicks; Glass and glassware; Kitchen utensils, Tableware; Tiles-vitrified and ceramic; Gas cylinders; Woven fabrics; Clothes; Plastic and rubber products; Polypropylene granules; Cellophane wrappers and bags; Soap and cosmetics; Tomatoes/tomato pastes, and Eurobond/foreign currency bond/share purchases.

Source : The source of this information is from an email, sorry links cant be shared.


 
9  Local / Nigeria (Naija) / Making bitcointalk writing much easier on: October 12, 2023, 08:38:02 PM
My brothers I carry one update come wey go fit help reduce stress of adding special character for our post dem or thread, though some persons fit kick against am because dem dey write directly for this site, but this tactics na for those wey dey do their writing outside this forum den transfer am after dem don finish, because writting inside this forum some time go make you feel like make you give up some times.
Reason I say so, this thing don happen to me many times, wen I don write enough thing to post sometimes my hand go mistakenly touch refresh and before you go know every thing don go, wen I give up to do my writing for this forum na wen I been dey translate one fillippone thread I don almost Finnish naim the page refresh, omor I wan ves spoil my phone that day but i just hold myself because na only me for still face the consequences, so because of that one I com go download note pad wey get undo and redo should in case any mistake arise.
So the update I dey carry come na like this, those wey dey write for digital note, na to just write all the most commonly used command for one page of the note then pin that one for the first page, for easy asses so when you wan use dem na to just go that place then copy am go paste for where you dey write.
This na the way I arrange my command dem:

Code:
1. [b]  [/b]
2. [url=  ]  [/url]
3. [url] [/url]
4. [quote] [/quote]
5. [list]
    [li] [/li]
    [/list]
6. [img width= height=] [/img]
7. [code]
etc
[/code]

So you fit copy the command go past for your note pad so that when you need am na to just extract am from there. This na image on how I take package my own.


And also the fastest way to take edit your post na for this button wey dey for right bottom corner of our post,  na the image be that. E go make us make easier and faster edit to our post rather than using the main edit button.
10  Local / Politics and society (Naija) / Some dangers in food we eat daily on: October 07, 2023, 11:29:18 PM
This na health matter naim I carry come oo, because Oyibo say "your health is your number 1 wealth" meaning your health even important pass money wey dey ur aza Lol, above all we nor go fit neglect our health for anything because if we nor dey healthy to even carry our laptop or phone write for this forum go tire us,and no way for us to go work wen we take dey get money sef, so today I come to talk about some food dem wey we dey eat for naija wey get nutritional benefit but in one way or the other e dey hammer our system and organs, and if we no take care e fit make us sick and we go spend better money take treat am.
True fact about food na be say, the way your body dey na because of the kind food wey you dey consume and some of these food dem if you no fit stop  am I go recommend make you reduce the way you take dey consume am.


1. Ice fish and frozen chicken:  this one dey very popular for the world at large and some persons dey consume am almost every day either fried, dried or steamed, even some public occasions na this food dem dey serve, the chemical wey dem take dey preserve this product na formalin and this formalin na very poisonous chemical wey severe exposure or only two table spoon fit cause death to human being, and this na still watin dem take dey embalm dead body for mortuary. So just imaging if only two spoon fit kill person that means the some percentage wey we dey take in through these food dey do small small unnoticed damage for our body system wey na long term effect.
Another alternative to take substitute this ice fish and frozen chicken na to buy fresh fish from our local surrounding like market eg na point and kill, river fish etc then for the fowl side na to buy alive fowl oo if e hungry you to chop.

2. Red meat (aka beef): this one go burst your head, red meat wey we fit get from cow, goat, ram, bush meat, etc research say if you eat am too often in large quantity say e go cause heart disease.
And for Nigeria we dey hardly hear of cancer but the most common among us naim be breast cancer]https://www.facingourrisk.org/XRAY/does-eating-meat-affect-breast-cancer-risk#:~:text=Among%20women%20who%20ate%20red,red%20meat%20(lowest%2020%25).]breast cancer and this red meat sef dey cause am. So any female wey u no wey dey eat red meat well well abeg, advise her to reduce the way she dey eat am oo. Those people wey be vegetarian na one of the best decision for life wey dem take be that o because the vitamin for the leaf wey dem dey eat well well go help dem build their immune system, and also leaf na one thing wey dey help the body to create enough blood.
Alternative for red meat na White meat, all poultry birds na white meat and you go fit use am replace red meat

3. Soda(aka soft drink): these soft drinks eg fanta, coke, sprit, Pepsi, etc are all soda and dey are know to containing sugar in large quantity, no mind the one way dem title zero sugar naim worst pass, soda get potential to cause  type 2 diabetes, obesity, fatty liver disease, and an increase risk of heart disease and cancer. No be only soda fit do this damage including fruit juice, all these drinks dem dey contain artificial sugar and that one nor dey good for the body, e fit cause bladder cancer.

4. Akpoo (aka fufu): for this modern day people nor dey get patients to do something well, I day I over hear person been dey say dem don dey use hypo to make cassava  ferment sharparly, so e no ho con reach the exact 3 days again na just few hours, and if you observe well for those of us wey dey buy am well well some of dem nor dey smell like den days, before if you eat akpoo person wet near you go no but now no way because of artificial process involved by large producers.
Then the one wey con pain me pass na the one wey I see korokoro when dem dey use kerosene for fresh akpu wey dem never pound say na for preservation, omor when I see this one my spirit first week I been just dey short of words.

Finally truth of the matter be say food wey dey last well well for our belle when nor dey make us hungry quick when we eat am, na because our liver dey struggle to digest am, to us we fit see am as economical food but to our health we dey over work the liver and this nor good for am eg akpoo, beans, red meat, fatty food etc. Even if e dey difficult to stop dem make we just minimize the wey we dey consume dem.

Sound in case you still no any other food wey dey harmful to our health you fit voice am oo.
11  Local / Nigeria (Naija) / NASA dey plan to build houses for moon on: October 05, 2023, 11:42:58 PM
Omor my brothers make una come see tori wey I carry come board today, NASA(National Aeronautics and Space Administration) don dey plan for  to build houses for moon just the way we dey watch for Hollywood fiction movies but this time around dem wan bring am to reality dem say because the moon get some kind of magnetic property wey dey pool things to itself say e go make the idea dey possible, and na 3d printing dem wan use take make the building. But dem still get some thing wey dey stand as treat to building houses for the moon, dem say the dust particles for the moon dey very toxic, but for me I dey see say that one na just 10% of problem wey dem get because only oxygen for one day for this country na 25,26 thousand, before dem ho com talk about food and other things.

But that one no be watin dey make me fear, the thing wey dey make me fear na be say, all of us dey the earth and we dey see the wey the government dey handle virus wey spread across the world matter, if dem com package house for moon you no sure say dem go leave us to die finish for earth? Because the heart of men are desperately wicked l, even after the covid e get one video semina wey some Americans been dey do and dem talk say by 2023 dem go reduce the world population by 50%. Just imaging how dem wan use take achieve this dream if no be to kill those wey dey exist?
If at all say by the 2040 dem don finally build the houses dem for the moon who know the kind of virus wey dem fit release upon us?
12  Bitcoin / Development & Technical Discussion / I need technical help and advice on: October 02, 2023, 03:52:27 PM
Greeting, bitcoiners sincerely speaking, I have no idea when it comes to understanding the technical aspect of bitcoin. And I deemed it very important in the life of every bitcoiner so, he or she will not be led to falling victim into the hands of scammer, to gain broader knowledge of how the system works and to understand basics of bitcoin wallet. But my exposure to its relative search topics for learning purpose isn't broad for a fresher like me.

I've come to request for any content, be it book, video, post etc that can help me in understanding the technical part of bitcoin. So can also be a contributor in the technical board and physical life situations
13  Local / Nigeria (Naija) / Tips to help you avoid being scamed on: October 01, 2023, 03:54:39 PM
My brothers and sisters I come with one ogbonga information come wey go fit help us identify scams dem wey dey trend every where, so we sef nor go fall victim. And the thing wey dey pain me pass for all these scammers and yahoo boyz na be say, dem nor care to know weda na only that money wey u get for ur life, so long as say dem don get access to ur account dem go wipe every thing finish. And because of all these kind shocking news some people dey from there dey pass out because of high BP, and I don even hear of case when person commit suicide after dem collect all em life savings. Na two category of scam wey I get in mind to share, and the two of dem na local scam(call scam) and cyber scam(internet scam).

Call scam
1. For this one dem try to scam me of resent but I sharp pass their trick, after my ATM card loss, person con call me say e get one interview wey e apply for, but e con mistakenly use my number take write for the paper (reason because my number and e own na only one digit difference so e con make mistake) say now the company don send message to my sim say make I send am the OTP.
But I nor send am because if to say I send am my account for dey bleed

2. My people if person call una say em dey call from una bank to solve small issue for ur account, no give am any more info about your account oo just cut the call, or call am scammer em go cut the call very fast. The truth be say dem go fit call your name, date of birth, state and your resident address so that dem go dey very persuasive but no believe dem oo, those na just information wey dem fit get from different place eg BVN

internet scam
1. Make we dey very careful for the kind of links dem wey we dey click, especially for WhatsApp, some people go post link say federal government wan give palliative, M-POWER don start to dey collect beneficiaries for their project, MTN dey give 1gb if u complete their survey, etc. My brother run from all these kind of links dem oo because some of dem nor dey secure and from there scammer fit hack ur devices.


All this kind sites wey get that triangle sign  instead of padlock, make u no say e nor dey secure oo. Na only sites with padlock sign nai dey secure


2.  Also note say inside all these WhatsApp links dem we fit send our details dem give scammers with our own hand, some of these links dem dey ask for personal details/information for example


And after u don put all ur details apply for the rubbish dem go com tell u to refer at least 10 persons so that dem fit get more victims, and from here naim some person go take know your name and all your info wey dem go use take call u. So abeg make we dey very careful for the kind of places wey we dey put our info dem because dem fit use am against us.

3. Mining sites: if una see any mobile site wey say e dey mine BTC, ETH, XRP etc just know say na scam, at some point some go say before u withdrew your coins u go get to deposit first, while some go say u go buy miner first( some persons fit cashout for like one week) but after that time, dem go carry people money Japa.

Abeg if u get any additional knowledge make u nor hesitate to drop am here, because e fit help person to avoid one when em see am.
14  Local / Nigeria (Naija) / Nigeria: As top bitcoin google in the world on: September 25, 2023, 11:22:44 AM
My country people I dey very happy to announce to all say Nigeria we country naim the the leader for world search about bitcoin, this one dey sweet my belle well well because, e mean say  the amount of people wey dey learn about bitcoin for Nigeria dey increase day by day, and the most important thing na be say we country con pass El Salvador wey don accept bitcoin as legal tender for their daily transactions.CLICK HERE

And e nor end there, to prove say we truely dey carry bitcoin for head for the world like this, we dey rank top 10 for the use of crypto in general and also binance con enter the matter con give data of the adoption rate for Nigeria. My brothers the turn up dey very encouraging.
15  Local / Nigeria (Naija) / Lesson to Bitcoiniers on: September 18, 2023, 10:13:07 PM
My brothers I carry this tory come make all of us learn from am oo, the ability of person to buy bitcoin, no be there e end oo, na just the first phase be that and I don see professionals dey advise say make e be say trading bitcoin to fiat or any other thing no too enter our head, because if we nor fit control our self even after we don get one kind gain from the holding of bitcoin, before you go know we don go sell our coin loss very big opportunity. Make we nor forget say time lost can never be recovered, opportunity wey we miss don go(otilor).

Although I no say we nor fit predict the future 100% every time, so some kind things fit happen wey dey against our will and we fit no get any other option than to sell, but if no be so abeg those wey dey into holding no give up easily. E get one baba wey share en experience of how e take loose guard with en coin, I believe say after we read am finish e go open our eye to see how this crypto life be like.



NOTE: out of 32 halving we still get 29 more wey go fit skyrocket the price of Bitcoin, so e never dey late for bitcoin holding and accumulating more coins.

I get question to ask my superior dem for this forum:
Abeg apart from emergencies, when be the right time wey person fit sell en bitcoin?
16  Other / Beginners & Help / I just purchased my first satoshis on: September 12, 2023, 05:58:28 PM
Hello guys congratulation to me, I just purchased my first  bitcoin, it really feels good knowing that it's one of the best decision I've made so far, I am proud of myself even if the start up amount is small, I hope to add to it consistently by the end of every month. I purchased the coin on an exchange but am looking forward to buy a Trezor hardware wallet for my coin storage.

I can't even express how exited I am, even if this is just the first phase, I believe the amount of knowledge I have accumulated about bitcoin through this forum will strengthened my emotion not to panic when the market goes bearish.

Thanks guy for your support, advice and wonderful opinion.
17  Other / Beginners & Help / My decision on bitcoin on: September 08, 2023, 07:25:21 AM
I recently created a post asking if I should buy bitcoin now or wait for the dip, and majority of the response I got from the post, advised that I should buy now rather than waiting for the dip due to its volatile nature, and I'm satisfied with this response and I'm willing to bear the risk.
Reason for all these questioning, I have a dream of becoming a long term bitcoin holder but, dreams aren't achieved with words alone, an action is needed for the start up, so I have decided to sell one of my less used phone for the purpose of buying bitcoin.
I'm really eager to purchase my first bitcoin in satoshi.
18  Other / Beginners & Help / Which is safest wallet for bitcoin long term holding? on: September 06, 2023, 08:00:50 AM
Hello guys with several wallets out there, I want to be sure make the right choice, because I have seen posts were members of this forum are complaining about some wallets and exchanges because of their unprofessional behavior.
So my question is, apart from electrum wallet which other wallet is the safest for long term holding of bitcoin?.

With the current reduction of price in Bitcoin, is it the best time to buy bitcoin or should I still wait for the dip?.
Though I have seen some post talking about "buy now or wait for the dip" but the debating answers got me confused, so I need the final clarity from you guys.
19  Local / Nigeria (Naija) / 5 Resources to use take teach ordinary person about bitcoin on: August 28, 2023, 10:43:49 PM
    Original Topic: 5 Resources to teach Average Joe about Bitcoin
    Author : fillippone




    Sometimes I dey see my self for places where I go answer this question:
    "I hear about this Bitcoin stuff, how I fit take buy am?"

    If at all, I nor dey like to take anyhow risk, and to buy Bitcoin wey person never know the coco wey dey inside, e  be like all those "investment wey person nor no anything for inside" and that one na sure plug to loss all your money.

    So I want mama dem/ordinary people to no how this Bitcoin dey work, before dem shook body put to go buy am.
    The problem na be say to explain this Bitcoin dey somehow hard; Bitcoin for crossroad to cryptography, Economic and Monetary theory, Game theory, Computer networking and data transmission. To know one of this field dem no only dey hard, but e also dey bias ur explanation, and e fit scatter the whole  explaining. (If I know plenty things about cryptography, I go use am to finish work for this side, but e nor dey 100% say e go trigger my counter part


    I wan post collection of better 5 resources (articles, videos, Twitter account, portals, ...just like that) so that people wey wan turn investors fit learn from.

    Na the list be this.
    My mind for this post na to dey update am continuously wen new materials dem come on board based on wattin ona want:

    • Lopp.net Bitcoin information & Resources
      This na collection of Bitcoin resources, from the starting wey dem dey read (white paper) to the once wey advance and hard, both written article and viseos/animation wey na from Jameson Lopp, professional cypherpunk ( abeg obverse well say na cypherpunk, no be cypberpunk)

    • Bitcoin for Beginners
      This na videos wey dey introduce Bitcoin by Andreas Antonopoulos, wey dey talk about another part of Bitcoin, wattin e be, how person fit take buy am, and how we fit store am...


    • The Bitcoin Standard: The Decentralized Alternative to Central Banking
      This one sweet well well to read, e nor dey hard and e nor dey too related to Bitcoin fully, if you nor fall in love with Bitcoin after u read this one nai be say, Bitcoin nor be for you be that.
      Quote
      as Bitcoin just dey show case face for this new computer age, the problems wey e fit solve old reach human society, that means e many well well: to transfer value from time and space. Ammous dey carry the reader mind for journey wey concern the history of tins wey don act as money for exchange,from the beginning wen dem dey trade limestone and seashell for metal, for coins, for gold, and nowadays government debt. if we look wattin give this all these tins dem the coco wey dem use dem as money, and how people dey loss dem, e dey give the reader the idea of wattin make dem fit dey like money, and e con arrange ground for economic discussion wey concern how the future of individual and the society wan be, including capital accumulation, trade, peace, culture, and art.
      To confirm the tori, Ammous still con show say no be by mistake wey societies wen human being don develop well well get better and stable money economy, or no be mistake say society wey economy don fall their civilization sef dey fall follow am.

    • BitcoinTalk.org Forum
      This one suppose to dey used to you, but I believe say if you don read the other 4 resources you suppose don ready to go into the Rabbit Hole [WARNING! TIME DEY SINK OO].


    This syde na other materials wey nor follow order, I put am because of the comment dem :






    • Binance Academy
      Na better videos and article wey dem explain well nai dey here for beginners so that dem go understand all the tins wey dey for cryptocurrency and trading.

    • Bitcoin for safety
      U need this one to know why you still need Bitcoin even wen e nor pure for your eye


    • The Dos and Don'ts for Bitcoin Key Management
      Quote
      Bitcoin dey give end users the ability and power for dem to use their own hand control their money. U fit don hear this word before "be ur own bank" this word dey explain the kind of power wey Bitcoin users get over their coin. Just that the bad syde na be say for you to be ur own bank responsibilities dem many. The same tin wey make Bitcoin get value (permissionlessness, censorship resistance, seizure resistance, etc.), naim still make am dey attractive for hacker. These hackers don com with plenty traps wey dem go use take fool Bitcoin users to thief their money, so that Bitcoin go come dey look unsafe. But nor forget say the internet na dangerous place oo, but we get the tools wey we go use take protect our self!

    • Why you for like to get some Bitcoin ( and how to get am responsibly)
      Quote
      this post get the coco wey I dey give friends n family wey dey new to Bitcoin. you go first start to watch wan short video, den u go cone buy some satoshi ( the smallest unit wey dey for bitcoin). U go con learn more tins about bitcoin, u go con choose the place dem wey sweet u as u dey read the content dem, for the end u go come understand the main reason wey make you suppose get bitcoin and how you go take buy more con store am for safe place.
    20  Other / Beginners & Help / Factor behind the rise and fall of Bitcoin price on: August 19, 2023, 09:49:34 AM
    Good day my fellow Bitcointalk members, i have been longing to ask this question, so I decided to come to you guys to learn from your wisdom rather than having a random online search which seem confusing most times.
    Please I want to know the factor behind the rise and fall of Bitcoin price?
    Some say its influenced by supply and demand but I need more conviction.

    Thanks in advance guys.
    Pages: [1] 2 »
    Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!