Proverb ; today cassava no fit turn garri tomorrow.
I believe sey na –
na im fit turn garri tomorrow, u bi wan write there.
Support PIGIN For Our Local Board...
Correct! Na d way to go be dat. We nor go take bc we dey abroad come begin use fork and spoon take eat eba/fufu/amala. Na hand we must use as local people wey we be.
You know say na old age dey make person forget some kind things wey dey happen around us at times, thank you for the correction my brother.
Wetin you talk na true, wetin we get na our own and nobody fit come from no where to take am from us, we fit learn ways of the white people no mean say we be white like them, imagine says some of us wan use their ways of doing things con forget say we get our own and our own go just die like that, our name na borrow borrow? e no make sense na...some of the whites Dem wan learn how we dey speak our PIGIN self... Our PIGIN no go fit die off no matter what, e good to use both and you see that garri/Amala/fufu/eba part, hmm nothing sweet pass to use hand oh ma no lie you
Support PIGIN For Our Local Board...