Bitcoin Forum
October 15, 2026, 08:04:55 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 31.1 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: « 1 2 3 4 5 6 7 8 9 [10]  All
  Print  
Author Topic: Info-thread: Translation of Useful English topics to Pidgin {mix images}  (Read 21831 times)
This is a self-moderated topic. If you do not want to be moderated by the person who started this topic, create a new topic. (3 posts by 1+ user deleted.)
Chilwell
Hero Member
*****
Offline

Activity: 1442
Merit: 701


SIG-830B212735


View Profile WWW
September 16, 2026, 05:10:05 PM
Merited by irfan_pak10 (3), Porfirii (1), GazetaBitcoin (1)
 #181

Original Topic: [FREE TOOL] NoFomoBTC — Bitcoin Converter, Analysis, Network & Learning Tools
Author: irfan_pak10



NoFomoBTC — Bitcoin tools wey no get FOMO
Money changer • Analysis • Market Calendar • Network • Where una go learn

beta tools wey dem create for crypto. E no get signals. E no dey predict. E no dey promise profit.

NoFomoBTC na set of bitcoin tools wey dey make especially for people wey wan know Bitcoin very well, people wey wan get useful information about bitcoin and understand am practically, without unnecessary hype or pressure.

For am to tell una wettin Bitcoin go do next, d site go help una check wettin dey happen for dat moment, e go help una study wettin happen before, e go also help una to understand d risk, and una go learn how Bitcoin dey take work normally.



1. Easy ways wey u go fit use convert Bitcoin



E go convert Bitcoin into fiat currencies and u no go get any problem with am, u go fit add plenty currency rows to compare dem values and e no go open different calculators. .

Highlights:
  • Live Bitcoin pricing via CoinGecko
  • Na every 10 seconds him prices dey updates
  • Multiple conversion rows
  • Easy ways wey u go fit use see all d necessary information



2. To study how Bitcoin Price dey move



D Analysis page dey show bitcoin price history, together with it moving averages, Bollinger Bands, support/resistance zones, RSI and MACD.

Make u choose among dem 24H, 7D, 30D, 90D and 1Y views. Zoom am, pan and check d exact price points.

Important: D page dey describe how d current situation of chart looks like. Dey no dey use am predict wettin go happen in d future, and e no bi buy or sell signal.



For am to hide everything under one score, d site dey show all d observations wey contribute to that particular reading.

Breakdown includes:
  • Trend
  • Momentum
  • Volatility and levels
  • Recent patterns
  • Support and resistance context



Setup Quality Check

A checklist for five conditions or things wey person suppose check after he don decides to trade, to know whether na good or bad idea.

Those things wey u go check na:
  • Multi-timeframe alignment
  • Trend strength
  • Risk-to-reward
  • Distance from resistance/support
  • Momentum extremes

Even though u get high score, e no mean say you're capable to trade ooo.



3. Na your AI u go use as your trainer



NoFomoBTC no go call an AI model for u ooo.

Instead, e go prepare a Socratic prompt wey go contain all your trade plan, e go contain d state of current chart and multi-timeframe readings. U go just copy dat prompt into your own ChatGPT, Claude or Gemini account.

D aim na for AI to challenge your sense of reasoning, how u go fit handle risk, exit plan and blind spots, e no go dey just predict d price for u like dat.

Dat same tool dey also compares indicators from different timeframes so dat u go understand wettin short-term readings means in another angle.



4. Strategy Backtester + Position Size Calculator



Strategy Backtester
  • make u replay simple historical rules
  • u go con choose d test window
  • u go also add d money wey dem go charge u for trading platform
  • put am at d back of your mind say d price fit change anytime
  • See wettin d rule for don do if una use am during d choosen period for d past

Position Size Calculator

E go calculate how much Bitcoin u go fit get based on d percentage of your account wey u dey ready to risk.



5. DCA History Explorer + Practice Trading Journal



DCA History Explorer

U fit go check how dem dey buy bitcoin before, using a particular amount and select time window. D tool dey also point out d uncomfortable part wey dey no dey usually put for headline, including when dey fail and how long e take dem to recover.

Practice Trading Journal

Make u record practice trade, and also write d reason why u take dem, entry, stop, target and position size.

Dey store d journal for browser and u go fit export am as CSV.



6. Market Mood



U fit see how people dey feel through Fear & Greed indicator, along with d information about how d top cryptocurrencies dey take perform within 24-hours.

Their aim na to show market mood, not to turn people's feelings or opinions into a prediction.



7. Market Calendar — Context, Not Predictions



D Market Calendar dey follow every event wey dem schedule, the events wey dey often happen at d same time when bitcoin price dey move up and down, including:

  • Fed/FOMC meetings
  • US CPI and PPI releases
  • Non-Farm Payrolls
  • Jobless Claims
  • BTC options expiry
  • Bitcoin halving-related events

D calendar go dey help d users know about compulsory event, so dat dey know go surprise if dey see any sudden movement for market.



Historical Review

Make u choose a past event type and check how Bitcoin dey normally move around previous occurrences.

D table go compares d movement of price at:
-4H, -30M, +30M, +1H, +4H, +24H and +7D.

Dis one na one of d main ideas is behind NoFomoBTC: the same type of event fit produce very different market reactions, So, na historical data dem dey show, instead of showing one simple story.



8. Bitcoin Network — The Engine Room



Dis page don stay away from price and e con show wettin d Bitcoin network itself dey do.

Live network information dem includes:
  • D different fee wey people are now paying for bitcoin transaction
  • D normal fee wey d transaction go cost
  • How busy d network dey always be
  • Transaction wey dem never confirm

Dey arrange d data in a way wey people go fit understand am easily.



U also fit track:
  • Number of d new mined block wey dey for bitcoin blockchain
  • total energy wey all d miners they use to mine
  • U go check whether any progress dey between d current halving and d next
  • How much time remain before e go do d next halving



9. The Academy



D Academy get 15 well arranged lessons and e go dey track your progress.

Topics wey show for d new curriculum na, price charts, what moves prices, candle patterns, market structure, support/resistance, moving averages, RSI, volume, wallets and more.

D ones wey dey for d Academy na:
Time Machine • Glossary • Scam Radar • Crash Museum



Dey arrange d lessons in a way wey people go fit understand am easily and also practicalise am to know whether u understand am.

For example, d wallet lesson contain all dis:
  • Private keys and public addresses
  • Seed phrases
  • Custodial vs non-custodial wallets
  • Hot vs cold storage
  • Practical security habits
  • Short knowledge checks



Why NoFomoBTC?

Sometimes crypto tools dey become another problem: signals, predictions, big claims, and d screenshot wey dey show d profits wey person fit make.

NoFomoBTC don take the opposite approach.

See the information.
Make you understand the context.
Test your ideas.
Make u manage risk.
Make u learn d system.
Make u dey make your own decisions.


Visit NoFomoBTC

Bitcointalk • X • Telegram • GitHub

Prices via CoinGecko. Sentiment via alternative.me. Network data via mempool.space. Not financial advice.



na AOBT na run dis Translation by Dem self


R


▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄
████████████████
▀▀▀▀█████▀▀▀█████
████████▌███▐████
▄▄▄▄█████▄▄▄█████
████████████████
▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀
LLBIT|
4,000+ GAMES
███████████████████
██████████▀▄▀▀▀████
████████▀▄▀██░░░███
██████▀▄███▄▀█▄▄▄██
███▀▀▀▀▀▀█▀▀▀▀▀▀███
██░░░░░░░░█░░░░░░██
██▄░░░░░░░█░░░░░▄██
███▄░░░░▄█▄▄▄▄▄████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
█████████
▀████████
░░▀██████
░░░░▀████
░░░░░░███
▄░░░░░███
▀█▄▄▄████
░░▀▀█████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀
█████████
░░░▀▀████
██▄▄▀░███
█░░█▄░░██
░████▀▀██
█░░█▀░░██
██▀▀▄░███
░░░▄▄████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀
||.
|
▄▄████▄▄
▀█▀
▄▀▀▄▀█▀
▄▄░░▄█░██░█▄░░▄▄
▄▄█░▄▀█░▀█▄▄█▀░█▀▄░█▄▄
▀▄█░███▄█▄▄█▄███░█▄▀
▀▀█░░░▄▄▄▄░░░█▀▀
█░░██████░░█
█░░░░▀▀░░░░█
█▀▄▀▄▀▄▀▄▀▄█
▄░█████▀▀█████░▄
▄███████░██░███████▄
▀▀██████▄▄██████▀▀
▀▀████████▀▀
.
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
░▀▄░▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄░▄▀
███▀▄▀█████████████████▀▄▀
█████▀▄░▄▄▄▄▄███░▄▄▄▄▄▄▀
███████▀▄▀██████░█▄▄▄▄▄▄▄▄
█████████▀▄▄░███▄▄▄▄▄▄░▄▀
████████████░███████▀▄▀
████████████░██▀▄▄▄▄▀
████████████░▀▄▀
████████████▄▀
███████████▀
▄▄███████▄▄
▄████▀▀▀▀▀▀▀████▄
▄███▀▄▄███████▄▄▀███▄
▄██▀▄█▀▀▀█████▀▀▀█▄▀██▄
▄██▀▄███░░░▀████░███▄▀██▄
███░████░░░░░▀██░████░███
███░████░█▄░░░░▀░████░███
███░████░███▄░░░░████░███
▀██▄▀███░█████▄░░███▀▄██▀
▀██▄▀█▄▄▄██████▄██▀▄██▀
▀███▄▀▀███████▀▀▄███▀
▀████▄▄▄▄▄▄▄████▀
▀▀███████▀▀
OFFICIAL PARTNERSHIP
SOUTHAMPTON FC
FAZE CLAN
SSC NAPOLI
Abdulzuruku01
Sr. Member
****
Offline

Activity: 868
Merit: 323



View Profile
October 09, 2026, 11:04:53 PM
Merited by Crypto Library (1)
 #182

Translated Topic in Pidgin Language; Complete Tutorial to use di ShareX with TalkImg/others for Newbie.  
Original Topic: Complete Tutorial for using ShareX with TalkImg/others for Newbie
Author: Crypto Library



I know say dey don already getsome tutorial but dem dey separate from each other. And na why I wan try to make dis tutorial as di complete guideline for whr e go dey possible to upload screenshot/GIF directly to Image Host(talkIMG/and other).

di most important part for dis tutorial no go be just to install ShareX but to take full advantage of em features, wey go make our process to take screenshots and upload dem manually much faster.

For long time now me sef no use ShareX even as I install am for my pc because I no see di better guidelines for am as first install am. Even my local mate dey for dis kind situation so I think I go make di tutorial about am as my local mate suggest.

First of all, make i tell you wetin we go fit do after we do dis tutorial-
  • We no go need to take di screenshot manually, save or copy am and den go to di image uploader and upload am.
        *We fit directly take di screenshot and upload am.
  • And for di same time, we fit edit am after we take di screenshot.
  • We fit upload di screen record as di GIF through di ShareX
  • e dey make everything easier with di right hot key setup

1. First, you go need to install ShareX from di official source.

2. Den, wetin I go suggest make you do be say na to set up di TalkImg API or any other image host wey you wan use.( For having di TalkIMG API you need to an account for di talkimg by PM joker_josue)
    I dey quote from RickDeckard post-

    
no be di option wey appear immediately, but once you take follow di first steps (Destination -> Custom uploader settings...) :


-*den you go need to copy di code from TryNinja's posts
1. Copy di code wey dey down.
2. Destination -> custom -> Import from clipboard -> Put your API key for where e talk say "API-KEY-HERE"

Code:
{
  "Version": "15.0.0",
  "Name": "TalkImg",
  "DestinationType": "ImageUploader",
  "RequestMethod": "POST",
  "RequestURL": "https://talkimg.com/api/1/upload",
  "Headers": {
    "X-API-Key": "API-KEY-HERE"
  },
  "Body": "MultipartFormData",
  "Arguments": {
    "type": "file",
    "format": "json",
    "description": "Uploaded by ShareX"
  },
  "FileFormName": "source",
  "URL": "{json:image.url}",
  "DeletionURL": "{json:image.delete_url}",
  "ErrorMessage": "{json:error.message}"
}
You go arrive for di new window where you fit click for Import -> From clipboard:


3. Now na di time to get di full benefit of em feature with proper setting and di hotkeys. And for dad I go like to suggest make you set all di hot keys like dis or you fit set am as you wish.
  


4. Den Click di After Capture Tasks> den select Open di Image Editor, Save Image for di fileremember say di highlight option na dem be di ones wey dey select , So dat when you go capture di screenshot em go take you to di editor interface where you fit edit di image and also to upload am directly.

- Image Editor Interface


5. Now click on di After Upload tasks den select di Show"After Upload" winodw and "Copy URL to di clipboard", So dat e go bring dis interface to copy di image link or image or save di image etc


6. For GIF hotkey settings, follow di screenshots-

 
Now, when you go press your Hotkeys(like- shift+ prt scr) for GIF capture, em go capture your screen and also automatically to di TalkImg


Now ShareX+TalkImg don dey ready to use.


"N.B.- Definitely, I believe say, ShareX fit be set up more professionally dan dis process wey I do, but I do dis tutorial for people wey dey new for basic and common use purposes. And for di same time, more tricks and suggestions dey welcome  Wink."

Other Languages-

Abdulzuruku01
Sr. Member
****
Offline

Activity: 868
Merit: 323



View Profile
October 14, 2026, 07:58:51 PM
 #183

    Translated Topic in Pidgin Language; How to use dice and di Seedsigner to make di seed phrase (with pictures)
    Original Topic: How to use dice and a Seedsigner to make a seed phrase (with pictures)
    Author: NotATether



    Note: Na di video wey @DocumentingBitcoin post for X, na em dis guide come from. No be me make di video.

    Di source: https://x.com/DocumentingBTC/status/2083895871364608178

    Prerequisites: Di Seedsigner, five dice (but any amount fit do), di sharpie and small paper.

    We go roll di dice 50 times to make di 12-word seed phrases. Like we go need make 50 dice rolls, no be say every dice go dey roll 50 times o.

    Make sure say u dey use casino dice or another balance type of dice make e no dey bias.

    1. Power for di SeedSigner

    Plug di Seedsigner with di micro-USB cable to di power source somewhere, turn am on, and make sure cameras no dey or any recording things wey go point for di device.



    2. Enter di dice rolls wey dey for menu

    From di main menu, go to Seeds -> Create di seed -> new seed (di one wey get dice icon)



    You go choose between 12 words and 24 words. 12 words dey require 50 rolls as I explained am, and 24 rolls needs 99 rolls.



    Also accept di warning we go show say make your seed must stay secret.

    3. Roll and enter do entropy

    Roll di dice and enter each number for di device use joystick/buttons. Just roll am one by one, no re-arrange di dice rolls into some silly order. Di screen go show di progress (e.g. "Dice roll 23/50" for "Enter di 23rd dice roll")



    When e don finish, do Seedsigner go generate di list of words like dis:



    4. Write di seed phrase

    You go use di sharpie to write am for di paper, or use metal backup plates so dat later you no go have to deal with torn paper.


    MAKE UNA NO USE DIS SEED - I JUST USE TO TEK SHOW UNA DI EXAMPLE ONLY

    After you generate am, you fit use di Seedsigner to export di xpub or zpub via di QR for di watch only wallet for some other software. xpub na for legacy addresses (startin with "1") and zpub na for di native segwit addresses (starting with "bc1q").[/list]

    Pages: « 1 2 3 4 5 6 7 8 9 [10]  All
      Print  
     
    Jump to:  

    Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!