Hatchy, I thruway salute for diz very informative thread wey you create so.
From the time wey this world start historical writings has been a part of us. Because if person no write and document about our history we fit forget and lose our identity or take the advantage wey we dey enjoy for granted.
As i dey read this history, e just be like say I dey read about the founding fathers of Nigeria, wey fight for our freedom from the British empire.
And from then wey CryptopreneurBrainboss create the Naija thread as you write for the history up till now, I don see the kind progress wey we don make for the forum. Three of which be say
- We don manage change the orientation of dem oyibo say Naija people na scammers
- We don also make dem see say for the forum na we, naija people be one of the hardest working and fastest group of all local boards.
- We don also make dem see say our contribution to the forum dey very important and dem nor fit ignore am.