Make una nor too vex, I think sey d ogbenge thing to do first na to warn the persin wey be like e dey spam so dem go adjust instead of tagging dem straight ahead. Some people nor go even know sey dem dey spam or wen dem spam, especially newbies. I nor know how d rules be here anyway as I nor read through everything but I nor sure sey I see something like dat for d OP.
You dey right and na wetin I do. You fit see di comment wey I leave for am
here, and I dey sure say him see am becus I expect any OP to visit him topic and read di comments. If to say him be lock those topics, e for show say him no really know say him dey spam or him dey sorry and wan improve. And wen finally di mata land for dis thread, maybe someone for plead on him behalf, but op ignore di warnings from me and oda persons, run go English board go continue der. But just as Amphenomenon talk, if him improve, oga sheriff go remove di tag.
Again, make una nor too vex sey I chook mouth for dis matta. Na just my $0.02 be dat.
Lolsss.. You na senior man and your input will always be valued.