First of, I go need to tell you say you the try cause to the update this exchange rate like this go help people wey wan do p2p to also get a clue of wetin the price dey at the moment so that those svammers wey dey bybit or any other exchanges no go wan act funny base on say person wey wan sell no no wetin the price dey as at when em wan sell, you do well baba.
In regards to your prediction, e no bad but you know how thing the be, e fit even drop small and come up again, that has been the pattern for some time now, but wetin I fit talk ne say, if e continue like this, e go boom pass #1500 before then although make we the watch.
The plan be say na to update thread every day so we go know di movement of dollar and naira so if people wan go exchange go trade and dem check here e go dey easy for them. But I mo fit do am like dat again and naim make I dey tell people dey do am so if you see person wey dey interested to update di thread daily, tell am make him come and do. I dey appreciate your encouragement of words.
Now the dollar is less than the cost of fuel which is the major economic driver in Nigeria and even households consumption, the cost of is almost 2,000 in some place's, this have made it hard for the impact of the dollar policy to be felt in the economy, alot of companies folding becasof lack of funding or regulatory demands most moved from Nigeria to other African countries. This shows the negative effects of the whole financial policy of the current administration. December may bring with it some growth for the dollar because of travel demands, but January the naira is going to gain against the dollar.
I no know weti I want talk again. Fuel nai come cost pass dollar. If to say fuel dey cheap, people go dey buy dey on gen dey get light. Di light wey him promised we no dey see and fuel sef no way. Make Tinubu no win dis coming election because di suffering e no be here.
Current dollar rate. Last week, the price come down to $1=N1,362 and as we dey took now. Na $1 = N1,423. Bitcoin price dey come down and di dollar dey rise. I think this one go balance the equation. And Christmas time things go go high.