Happy New year my 9ja people, I nor bring too dey active for here due to some personal issues, I just hope say I go fit pick up from where I stop and at least gain more knowledge about Bitcoin from una.
Wetin I wan talk about na be say, we Dey ever late to deh start to deh stark up Bitcoin small small? I nor think say we don late. Maybe we Dey think say since we nor reach adopt am when e come out the first time, say price don leave the stage wey we fit start to Dey accumulate am, I go advise say make we nor Dey think like that, rather as we deh work dey save money and we Dey keep small small money as our spare money for corner incase of something happen, we fit go carry part of am take buy small portion of Bitcoin first keep, then when the next week or month reach as you don settle all your necessary needs them, the remaining money you divide am, take like 40% take buy small again. Just like that, if you deh consistent you go found out say the 1 Bitcoin wey you deh see as too big you don dey accumulate am small small deh go. This method so dem deh call DCA (Doller Cost Average). Other method sef deh wey be Buying the dip and Lump sum, but as person wey being dey fear to start I go advise make you first stick to this DCA method, until you don gather plenty money then you fit use other method as e take suit you.
Nor come Dey compare yourself to your childhood friend wey don first you start to adopt Bitcoin early or people dem wey dey online, na you just deh feel insecure rather them suppose deh inspire you sef. Oya check out, you deh think say you deh late, Michael Saylor just buy $2B worth of Bitcoin not quite long. As soon as you fit comot that fear, tell yourself say you nor big pass Bitcoin and Bitcoin nor big pass you, say you nor fit control am, rather you fit join body do as other dey do, you con consider as am one important thing, you sef go shock the level wey you go reach, nor come deh underestimate yourself. Try join the network so that you sef go Dey think like other people wey deh there before you, nor form of ranking deh for there rather na just you and your hodling, you go find out say you sef don become one of the Bitcoiners. Instead of to dey think say you Dey late to Bitcoin.
One way or the other, you gats put your money for somewhere, your time, your labor, your energy, you nor go tell me say you won store am for history, e nor deh possible. As you dey wake up every day you deh contribute value to people around your surrounding. Bitcoin self na place way you fit orchestrate does forms of value take put. Also get am for the back your mind say Bitcoin nor be hedge over anything rather na solution.
Other methods are go to shock of the possibility of insecurity just like that the most thing people face in form is that lack understanding of dollar cost average second used Bitcoin as the investment of fair people to think about scum so I go adive make people dey think before go to the investment if knowledge basis in their brain think about Bitcoin is almost good to be fit good idea to understand for it but the importance thing in the right direction them for more information about it