Mpamaegbu (OP)
Legendary
Offline
Activity: 2870
Merit: 1233
Once a man, twice a child!
|
|
July 31, 2021, 10:05:21 PM |
|
No be much wahala to grow big teeth but na to grow big lips to cover am be the gbenge.
Meaning: One should have a mastery of how to wriggle oneself out of troubles if one can't abstain from them.
Make we even use this Abba Kyari (the police officer turned tailor 🙊)and Hushpuppi gbenge take do example for this proverb sef.
|
|
|
|
XCANA
|
|
July 31, 2021, 10:19:20 PM Last edit: September 11, 2021, 07:06:16 AM by XCANA |
|
Make I shop this Man money Make I shop this Man money Na so Ashawo take de start ooo!!
|
|
|
|
Smartvirus
Legendary
Offline
Activity: 1610
Merit: 1151
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
|
|
July 31, 2021, 11:07:14 PM Last edit: August 02, 2021, 07:19:09 PM by Smartvirus |
|
My people! I get one small gist for una oh. Oya, make una dress come nearer...
Bring ya right ear make I whisper the thing... Nor shout oh!
Em.. em.. I finally stepped up yesterday oh to Hero!
Betta jollof for all man na oh... Make una go read my ogbenge post wey I take thank all of una for reputation.
😏
Omo, congrats my won person. No be play o, we do dey agther strength finish for we corner. Una rep no be here. I go show back to arrange this thing well but, make e first dey like this. Congrats man. Omo, you try too o. No be play o because, to dey determine then, you con dey make impact after you don dey see money from signature them and other opportunities way dey the forum eh, e dey make building account and making quality post them hard true true. The fact say, you still get strength to get of yourself con push forward dey drop one or twos on a steady way con make you get watin you need to top up so eh, you na really strong man. E dey your body no worry. Faji, we dey with you.
|
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary
Offline
Activity: 2870
Merit: 1233
Once a man, twice a child!
|
|
August 01, 2021, 05:09:53 PM |
|
Make I shop this Man money Make I shop this Man money Na so Shawo take de start ooo!!
I welcome you to this corner, brotherly. Nice proverb but next time make you try explain wetin e mean as na the format for here. E even be like sey we don use dat proverb here sef. But all the same, nice one 👍.
|
|
|
|
CryptocurencyKing
|
|
August 01, 2021, 08:44:25 PM |
|
My people! I get one small gist for una oh. Oya, make una dress come nearer...
Bring ya right ear make I whisper the thing... Nor shout oh!
Em.. em.. I finally stepped up yesterday oh to Hero!
Betta jollof for all man na oh... Make una go read my ogbenge post wey I take thank all of una for reputation.
😏
My naija brother, man way sabi, man way get level, man way dey do well, the man with the coolele water, I salute you ruggedly. You too much. Bible say, man way get plenty, make them give am even more. I no know the portion but na so e be. Na more you don get so, imagine The Pharmacist dey tell you to apply for en hand,,, e shock me brotherly. That mean say, your face show scatter and them dey see the work way you dey do for here. Na so e suppose be and na so e gets be. Omo, faji your new rank, e sure for you no be chaise and the cloth cef without measurement go fit you scatter when you wear am @sig. Omo, lead us dey go, we dey your back.
|
| | . .Duelbits│SPORTS. | | | ▄▄▄███████▄▄▄ ▄▄█████████████████▄▄ ▄███████████████████████▄ ███████████████████████████ █████████████████████████████ ███████████████████████████████ ███████████████████████████████ ███████████████████████████████ █████████████████████████████ ███████████████████████████ ▀████████████████████████ ▀▀███████████████████ ██████████████████████████████ | | | | ██ ██ ██ ██
██ ██ ██ ██
██ ██ ██ | | | | ███▄██▄███▄█▄▄▄▄██▄▄▄██ ███▄██▀▄█▄▀███▄██████▄█ █▀███▀██▀████▀████▀▀▀██ ██▀ ▀██████████████████ ███▄███████████████████ ███████████████████████ ███████████████████████ ███████████████████████ ███████████████████████ ███████████████████████ ▀█████████████████████▀ ▀▀███████████████▀▀ ▀▀▀▀█▀▀▀▀ | | OFFICIAL EUROPEAN BETTING PARTNER OF ASTON VILLA FC | | | | ██ ██ ██ ██
██ ██ ██ ██
██ ██ ██ | | | | 10% CASHBACK 100% MULTICHARGER | │ | | │ |
|
|
|
Smartvirus
Legendary
Offline
Activity: 1610
Merit: 1151
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
|
|
August 02, 2021, 07:28:15 PM |
|
I get small proverb to drop for una but then before I drop am, I wan first congratulobia for all of una way dey make things dey be for here and the forum. Una dey try to make sure say, we naija for here eh, them no fit live us for corner 9n any serious matter and for things way be say, e go improve the forum. Una sabi the thing no be lie. Oya na, make we here am as our papa them dey talk am.
Proverb Pighin: my people dey talk say, person way hold stick for hand, e good make e hold ofor too (Na igbo Proverb e be normally) English: a saying goes that, someone who handles a stick, uts also good thenperson handles an ofor (Ofor here means: a symbol of peace or honour) Meaning: It's not always good to go with the mindset of war or destruction, be peaceful most times you can, its more better.
Na so e just be. Make we live well with one another, na we get ourselves.
|
|
|
|
Smartvirus
Legendary
Offline
Activity: 1610
Merit: 1151
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
|
|
August 04, 2021, 02:07:22 PM |
|
E get small proverb way be say eh, I still dey reason am because, e no really agree well with me since I hear am. The niqjq wise quote carry talk say;
Proverb; Pighin: Your ear no go ever fit grow pass your head English: Your ears can never grow more than your head Meaning: Some one that has passed you in whatever level of life endeavor has past you. Your best chance is to learn from him or her in order to be like him or her.
Omo, e get as this talk be. I agree with the talk say, ear no fit grow pass person head but, the side way talk say, person way pass you don pass you finish, me no gree o. I know say, life fit be like that but, na via say you allow am to be like that. Na when you do something with situation e dey change o. How una see this talk?
|
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary
Offline
Activity: 2870
Merit: 1233
Once a man, twice a child!
|
|
August 04, 2021, 02:27:46 PM |
|
Meaning: Some one that has passed you in whatever level of life endeavor has past you. Your best chance is to learn from him or her in order to be like him or her.
Another proverb wey resemble that one be – no matta how pikin get cloths reach, im nor fit get rags pass im papa. Person wey pass person still pass am, no matta what. E just be like as people begin compare Cubana Chief Priest with the main Cubana dude himself wey be Obi Cubana. The matta nor relate well at all na. The Chief Priest imsef sabi sey na boy wey im still be to Obi Cubana no matta d small change wey enta im hand.
|
|
|
|
XCANA
|
|
August 04, 2021, 08:18:39 PM Last edit: August 04, 2021, 11:37:03 PM by XCANA |
|
Pesin way never see wahala na him the use English pray oooo!!!
|
|
|
|
Smartvirus
Legendary
Offline
Activity: 1610
Merit: 1151
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
|
|
August 05, 2021, 05:30:30 PM |
|
Meaning: Some one that has passed you in whatever level of life endeavor has past you. Your best chance is to learn from him or her in order to be like him or her.
Person wey pass person still pass am, no matta what. E just be like as people begin compare Cubana Chief Priest with the main Cubana dude himself wey be Obi Cubana. The matta nor relate well at all na. The Chief Priest imsef sabi sey na boy wey im still be to Obi Cubana no matta d small change wey enta im hand. Like play like play, this Obi Cubana name don turn something way go tai before people go forget am o. See name way been dey exist but, people no bin dey really think of am plenty and now, e don dey turn watin my guy dey use make analogy, lol... Anyhow shah, the proverb way you drop so resemble my won shah but, if you check am well eh, if we wan commot respect be that o because, correct boy go always wan pay respect to e master. If we wan look am via hustle side, boy fit actually get the pepper pass en master o. If you check watin I talk now, you go see say I use 'pass', that na to mean say, e fit or e dey happen. In fact, many times cef. Like if we look Wizkid and Banky now for the industry, e go hard for anybody to believe say, Wizkid no pass Banky W na!
|
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary
Offline
Activity: 2870
Merit: 1233
Once a man, twice a child!
|
|
August 09, 2021, 05:34:35 AM |
|
Persin wey swallow complete full coconut must to get ogbenge trust for where im anus dey to poopoo am. . Meaning: E mean sey before you go find trouble come make you kuku make sure sey you go fit tackle am wen e touch you.
|
|
|
|
Smartvirus
Legendary
Offline
Activity: 1610
Merit: 1151
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
|
|
August 09, 2021, 10:14:06 PM |
|
Persin wey swallow complete full coconut must to get ogbenge trust for where im anus dey to poopoo am. . Meaning: E mean sey before you go find trouble come make you kuku make sure sey you go fit tackle am wen e touch you.
All this strong talk eh, I dey wonder watin these men them way talk am been dey think before them reason this kind thing. Who wan swallow coconut kwanu,,, that person go really get mind o because, na very big whala be that shah. The type way go tia your yansh cef unless e elastic enough. No sire say I fit trust my yansh reach that level, lol. Na true the talk be shah, infact eh, no fine trouble at all because, that man way you dey under rate, e fit turn put to be oga o or e fit get person way sure for en side. Like e dey be for madman until you jam am. For the life eh, e sure say you just dey your lane, make you no cast.
|
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary
Offline
Activity: 2870
Merit: 1233
Once a man, twice a child!
|
|
August 17, 2021, 06:35:27 AM |
|
Persin wey go sleep wen im anus dey itch am go wake up with smell smell fingers. –Confucius bin chook mouth for dis matta too. Meaning: A problem left unresolved escalates with time.
|
|
|
|
Pokapoka124
|
|
August 17, 2021, 09:46:56 AM |
|
Proverb; Pigin: All die na die Meaning: Don't be afraid of failing
|
..Stake.com.. | | | ▄████████████████████████████████████▄ ██ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ██ ▄████▄ ██ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ██████████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ██ ██████ ██ ██████████ ██ ██ ██████████ ██ ▀██▀ ██ ██ ██ ██████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██████ ██ █████ ███ ██████ ██ ████▄ ██ ██ █████ ███ ████ ████ █████ ███ ████████ ██ ████ ████ ██████████ ████ ████ ████▀ ██ ██████████ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ██████████ ██ ██ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ██ ▀█████████▀ ▄████████████▄ ▀█████████▀ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄███ ██ ██ ███▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ██████████████████████████████████████████ | | | | | | ▄▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▄ █ ▄▀▄ █▀▀█▀▄▄ █ █▀█ █ ▐ ▐▌ █ ▄██▄ █ ▌ █ █ ▄██████▄ █ ▌ ▐▌ █ ██████████ █ ▐ █ █ ▐██████████▌ █ ▐ ▐▌ █ ▀▀██████▀▀ █ ▌ █ █ ▄▄▄██▄▄▄ █ ▌▐▌ █ █▐ █ █ █▐▐▌ █ █▐█ ▀▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▀█ | | | | | | ▄▄█████████▄▄ ▄██▀▀▀▀█████▀▀▀▀██▄ ▄█▀ ▐█▌ ▀█▄ ██ ▐█▌ ██ ████▄ ▄█████▄ ▄████ ████████▄███████████▄████████ ███▀ █████████████ ▀███ ██ ███████████ ██ ▀█▄ █████████ ▄█▀ ▀█▄ ▄██▀▀▀▀▀▀▀██▄ ▄▄▄█▀ ▀███████ ███████▀ ▀█████▄ ▄█████▀ ▀▀▀███▄▄▄███▀▀▀ | | | ..PLAY NOW.. |
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary
Offline
Activity: 2870
Merit: 1233
Once a man, twice a child!
|
|
August 17, 2021, 05:25:27 PM |
|
Proverb; Pigin: All die na die Meaning: Don't be afraid of failing
True! Dat na short but ogbenge proverb. I like d message wey e carry as it's relevant in today's world. People wan go heaven but dem dey fear to die.
|
|
|
|
Smartvirus
Legendary
Offline
Activity: 1610
Merit: 1151
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
|
Proverb; Pigin: All die na die Meaning: Don't be afraid of failing
True! Dat na short but ogbenge proverb. I like d message wey e carry as it's relevant in today's world. People wan go heaven but dem dey fear to die. My people, my people, oh! Rugged youuuuu, e sweet meeeee! Na the naija spirit be this, e no get how e wan be! E get proverb way I hear and e loud scatter. Una no go miss am, no worry. Hear am; Proverb; E go like this for the pighin: them say the best way to chyke deaf and dumb way e go understand say you wan run bedroom matters with her, na to find way show am your prick. For the Englishman: The best way to ask out a deaf and dumb and make her know you have plans of sleeping with her is to find a good time and show her your d*ck. Meaning: At times, it's just easier to understand by going straight to the point!
|
|
|
|
Smartvirus
Legendary
Offline
Activity: 1610
Merit: 1151
Playbet.io - Crypto Casino and Sportsbook
|
|
August 19, 2021, 05:12:46 PM |
|
E be like the thing dey my body this days o. Make I dey throw way for una make we all dey learn dey go
Proverb: For the Pighin: them say our forefathers them dey talk say, no matter how toro-toro big or fine reach, them no dey still use am do sacrifice for the gods. Pighin to English translation: my people use to say, our forefathers did say, no matter how big and cute the turkey might be, it would never be suitable for sacrifices to the gods. Meaning: There are things and ways that are best suited for some things. How appealing a thing looks doesn't matter at that point rather than doing it how it ought to be done.
|
|
|
|
Pokapoka124
|
|
August 20, 2021, 01:29:35 AM |
|
Proverb; Pigin: All die na die Meaning: Don't be afraid of failing
True! Dat na short but ogbenge proverb. I like d message wey e carry as it's relevant in today's world. People wan go heaven but dem dey fear to die. Mpamaegbu your skin full u don wet my body with coolele water nor be small I salute you ruggedly as them dey talk for pitakwa. Pigin: If you cook food for community them go chop am finish but if community cook food for you...you nor go fit finish am Meaning: A united people is stronger than a single force
|
..Stake.com.. | | | ▄████████████████████████████████████▄ ██ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ██ ▄████▄ ██ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ██████████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ██ ██████ ██ ██████████ ██ ██ ██████████ ██ ▀██▀ ██ ██ ██ ██████ ██ ██ ██ ██ ██ ██ ██████ ██ █████ ███ ██████ ██ ████▄ ██ ██ █████ ███ ████ ████ █████ ███ ████████ ██ ████ ████ ██████████ ████ ████ ████▀ ██ ██████████ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ██████████ ██ ██ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ██ ▀█████████▀ ▄████████████▄ ▀█████████▀ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄███ ██ ██ ███▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ██████████████████████████████████████████ | | | | | | ▄▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▄ █ ▄▀▄ █▀▀█▀▄▄ █ █▀█ █ ▐ ▐▌ █ ▄██▄ █ ▌ █ █ ▄██████▄ █ ▌ ▐▌ █ ██████████ █ ▐ █ █ ▐██████████▌ █ ▐ ▐▌ █ ▀▀██████▀▀ █ ▌ █ █ ▄▄▄██▄▄▄ █ ▌▐▌ █ █▐ █ █ █▐▐▌ █ █▐█ ▀▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▀█ | | | | | | ▄▄█████████▄▄ ▄██▀▀▀▀█████▀▀▀▀██▄ ▄█▀ ▐█▌ ▀█▄ ██ ▐█▌ ██ ████▄ ▄█████▄ ▄████ ████████▄███████████▄████████ ███▀ █████████████ ▀███ ██ ███████████ ██ ▀█▄ █████████ ▄█▀ ▀█▄ ▄██▀▀▀▀▀▀▀██▄ ▄▄▄█▀ ▀███████ ███████▀ ▀█████▄ ▄█████▀ ▀▀▀███▄▄▄███▀▀▀ | | | ..PLAY NOW.. |
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary
Offline
Activity: 2870
Merit: 1233
Once a man, twice a child!
|
|
August 22, 2021, 06:05:20 PM |
|
Mpamaegbu your skin full u don wet my body with coolele water nor be small I salute you ruggedly as them dey talk for pitakwa.
My broda, na wetin we get na im we dey throwey take baff all man wey make sense. Na so e supposed be na. But those wey dey act like crab and aradite to dey gum dem own for body without vomiting am na dem sabi. May be dem go carry am go to contest for 2023 elections for Also Rock. My advice be sey make all man just shine eyes and dey digidigbam like dat so una nor go enta walahi. And those of us wey dey high here go dey help as we fit reach. Na one love.
|
|
|
|
Pokapoka124
|
|
August 23, 2021, 08:52:02 AM |
|
Pigin Proverb: Anyhow e be ogoro must jump Meaning: What will happen will happen you can't change it Proverb: When the king asks for meat he does not wish to hear the story of the cow Meaning: There is no refusal to those in the corridors of power. The powerful always get their way