Mpamaegbu (OP)
Legendary
Offline
Activity: 2758
Merit: 1226
Once a man, twice a child!
|
|
August 25, 2021, 05:09:28 PM |
|
Pigin Proverb: Anyhow e be ogoro must jump
Oh, so na jumb e bi? I bin dey think sey na "Ogoro must drop" oh 🙊. BTW, wetin be "Ogoro" sef? Pikin wey im Papa sey make im break door dey use two legs break the door.Meaning: Those who have the support of patriots go extra mile in whatever they do.
|
Before you boast of your material acquisition, take a stroll to a morgue and there you will find those who were once better than you're. Only fools think they've it all. Stay humble 🤔
[/color]
|
|
|
Pokapoka124
|
|
August 26, 2021, 08:53:27 AM |
|
Pigin Proverb: Anyhow e be ogoro must jump
Oh, so na jumb e bi? I bin dey think sey na "Ogoro must drop" oh 🙊. BTW, wetin be "Ogoro" sef?
Ogoro means Frog. Jumping nai be frog mode of locomotion. Proverb: Na the same walking stick way dey help you waka nai go still break your leg if you nor hold am well Meaning: Treat everyone and everything with care because even the most harmless thing can become deadly if misused
|
|
|
|
Rruchi man
Legendary
Offline
Activity: 1358
Merit: 1097
Bitcoin Casino Est. 2013
|
|
August 27, 2021, 02:50:11 PM |
|
First post on this board, very excited, first first i cut cap cun troway salute give everybody for the house wey dey make things and things dey sup for here...make una permit me, make i use two secs drop small wisdom make the jollof for reach me.
Pigin Proverb: As you dey do, try dey do jeje make you nor go put hand for tortoise yansh.
Meaning: Be careful in everything you do, so you don't put or find yourself in a very tight corner.
|
| | | | | | | ███▄▀██▄▄ ░░▄████▄▀████ ▄▄▄ ░░████▄▄▄▄░░█▀▀ ███ ██████▄▄▀█▌ ░▄░░███▀████ ░▐█░░███░██▄▄ ░░▄▀░████▄▄▄▀█ ░█░▄███▀████ ▐█ ▀▄▄███▀▄██▄ ░░▄██▌░░██▀ ░▐█▀████ ▀██ ░░█▌██████ ▀▀██▄ ░░▀███ | | ▄▄██▀▄███ ▄▄▄████▀▄████▄░░ ▀▀█░░▄▄▄▄████░░ ▐█▀▄▄█████████ ████▀███░░▄░ ▄▄██░███░░█▌░ █▀▄▄▄████░▀▄░░ █▌████▀███▄░█░ ▄██▄▀███▄▄▀ ▀██░░▐██▄░░ ██▀████▀█▌░ ▄██▀▀██████▐█░░ ███▀░░ | | | | |
|
|
|
Pokapoka124
|
|
August 27, 2021, 03:48:34 PM Last edit: August 28, 2021, 07:09:00 AM by Pokapoka124 |
|
First post on this board, very excited, first first i cut cap cun troway salute give everybody for the house wey dey make things and things dey sup for here...make una permit me, make i use two secs drop small wisdom make the jollof for reach me.
Pigin Proverb: As you dey do, try dey do jeje make you nor go put hand for tortoise yansh.
Meaning: Be careful in everything you do, so you don't put or find yourself in a very tight corner.
Welcome na here strong men dey cap intellectual. This na one of my favorite threads for forum o I know say you go enjoy am too. Shout out to Mpamaegbu for creating this place for kontri people. Proverb: Workman way nor sabi work go always blame him tools Meaning: Only incompetent people blame others for their failures Proverb: who dey drown for water nor sabi wetin be patience oMeaning: A desperate person will do anything to survive
|
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary
Offline
Activity: 2758
Merit: 1226
Once a man, twice a child!
|
|
August 28, 2021, 06:56:24 AM |
|
First post on this board, very excited, first first i cut cap cun troway salute give everybody for the house wey dey make things and things dey sup for here...make una permit me, make i use two secs drop small wisdom make the jollof for reach me.
Na real jollof oh... 😅. Well, no shaking. Once the proverb tight I go baff d person wey send am with colele water if cold water dey my side. Dat wan nor be issue at all. But dat your proverb na mad oh! E crack me up small and I take style imagine how the pain go be too. Nice one. Again, wellu come to owa old people corner where we dey take wisdom and ogbenge sense totori owaselves. ~snipped
I like your second proverb. And e also remind me of prayer warriors wey dey pray for people and dey tell dem to get faith. But wen the thing rough for prayer warriors dem side most of dem nor dey exercise dat faith oh. Bros, abeg I go like make you follow owa format to dey put the proverb for bold s lolo we go easily catch am. Tanku
|
Before you boast of your material acquisition, take a stroll to a morgue and there you will find those who were once better than you're. Only fools think they've it all. Stay humble 🤔
[/color]
|
|
|
Rruchi man
Legendary
Offline
Activity: 1358
Merit: 1097
Bitcoin Casino Est. 2013
|
|
August 30, 2021, 12:42:50 AM |
|
Some more wisdom for the culture.
Proverb: Hawk go chop butterfly wey say e wan dey fly like bird. Meaning: Try to be yourself at all times
Proverb: You nor dey carry basket go river say na water you wan fetch. Meaning: You have to be properly prepared for any task at hand
Proverb: Dem nor dey carry two leg dey check if water dey deep. Meaning: Exercise caution when trying out something new
|
| | | | | | | ███▄▀██▄▄ ░░▄████▄▀████ ▄▄▄ ░░████▄▄▄▄░░█▀▀ ███ ██████▄▄▀█▌ ░▄░░███▀████ ░▐█░░███░██▄▄ ░░▄▀░████▄▄▄▀█ ░█░▄███▀████ ▐█ ▀▄▄███▀▄██▄ ░░▄██▌░░██▀ ░▐█▀████ ▀██ ░░█▌██████ ▀▀██▄ ░░▀███ | | ▄▄██▀▄███ ▄▄▄████▀▄████▄░░ ▀▀█░░▄▄▄▄████░░ ▐█▀▄▄█████████ ████▀███░░▄░ ▄▄██░███░░█▌░ █▀▄▄▄████░▀▄░░ █▌████▀███▄░█░ ▄██▄▀███▄▄▀ ▀██░░▐██▄░░ ██▀████▀█▌░ ▄██▀▀██████▐█░░ ███▀░░ | | | | |
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary
Offline
Activity: 2758
Merit: 1226
Once a man, twice a child!
|
|
August 31, 2021, 12:12:03 AM |
|
Some more wisdom for the culture. ~
Proverb 1 ✅ Proverb 2 ✅ Proverb 3 ✅ Na real wisdom you share there my broda. Even though I don hear dem before but d way wey you take put am for pidgin come make d thing don wella. I go pour you colele wata wen food done. This owa corner dey really help us to sharpen d native part of owa brain, nor be so 🤔. At least wen we gather for where old people dem dey for village or even town we too go fit surprise dem with owa contributions too with proverbs. Una dey try here.
|
Before you boast of your material acquisition, take a stroll to a morgue and there you will find those who were once better than you're. Only fools think they've it all. Stay humble 🤔
[/color]
|
|
|
Smartvirus
Legendary
Offline
Activity: 1498
Merit: 1137
|
|
September 02, 2021, 11:41:44 AM |
|
Some more wisdom for the culture.
Proverb: Hawk go chop butterfly wey say e wan dey fly like bird. Meaning: Try to be yourself at all times
Omo, this one sure just now. E familiar small but, the context way e carry come na em make the thing dey sweet for ear! I get emails them here no worry. Make I throw one for una Proverb: For we Pighin: My people say, pikin way no wan survive na em go tell e papa say, make e carry pestle (mortar and pestle) use as bow to take shot arrow. For Oyibo English: A saying in my place goes, it is the child that doesn't want to survive that would tell the father to use a pestle (Mortar and pestle) for a bow and shot an arrow. Meaning: it is one who is not willing or ready to archive a thing that would make the process or proceses difficult for the helper. Try to keep it to a minimum, help out and you might be good to go.
|
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary
Offline
Activity: 2758
Merit: 1226
Once a man, twice a child!
|
|
September 03, 2021, 04:22:45 AM |
|
Smartvirus, I come begin reason how e go even be to try use pestle shoot something like arrow until you come explain am. D thing enta brain wella, and na true talk. How you go give persin wey wan help you overload like dat and expect am to achieve result. Anoda proverb wey resemble dat your own be:
Pikin wey dem carry for back nor dey sabi sey road far
You sabi how e dey be wen dem back pikin (piggy back, if na oyibo language) and e go just dey play for d back wey im dey na.
|
Before you boast of your material acquisition, take a stroll to a morgue and there you will find those who were once better than you're. Only fools think they've it all. Stay humble 🤔
[/color]
|
|
|
Smartvirus
Legendary
Offline
Activity: 1498
Merit: 1137
|
|
September 06, 2021, 05:37:12 PM |
|
Omo @Mpamaegbu, na so I for carry miss you for this we corner o but, God dey shah and this one show say, you na real man of the people with the way people come out con voltage for you. I just get joy say, you d0n show back to join body with me make we dey carry this our corner dey go, na you be the ginger for here and me no for fit do am alone. Oya o, one proverb turn up for we matter...
Proverb: In pighin: our people dey talk say, person way shit for road dey easily forget but, person way mash the shit, e no dey or e dey hard am to forget.
I go live this one like this, make we carry our head reason am ourselves. You dey very welcome brother, you don teach us the importance of living right and making friends. Welcome back Mpamaegbu!
|
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary
Offline
Activity: 2758
Merit: 1226
Once a man, twice a child!
|
|
September 07, 2021, 05:37:23 AM |
|
Omo @Mpamaegbu, na so I for carry miss you for this we corner o but, God dey shah and this one show say, you na real man of the people with the way people come out con voltage for you. I just get joy say, you d0n show back to join body with me make we dey carry this our corner dey go, na you be the ginger for here and me no for fit do am alone.
Yes oh! Na Baba God get owa back oh. Una see as something wey dey small wan rob me of greater joy. E touch me wen I come remember how dis corner for be if I nor dey around. E make me feel wetin men wey get fine young wives dey feel when dem realize sey dem wan die 😅 Proverb: In pighin: our people dey talk say, person way shit for road dey easily forget but, person way mash the shit, e no dey or e dey hard am to forget.
Dis ya proverb enta brain wella. I fit even relate am with my recent case sef. D guy wey report me nor even sabi wetin I pass through as na me wey mash d shit wey im shit sabi how e bi for body.
|
Before you boast of your material acquisition, take a stroll to a morgue and there you will find those who were once better than you're. Only fools think they've it all. Stay humble 🤔
[/color]
|
|
|
adeyemirichard71
Newbie
Offline
Activity: 25
Merit: 1
|
|
September 07, 2021, 03:14:38 PM |
|
Omo this proverb dey to tori my brain, make me self drop my own for una Proverb If wall no open, wizard no go enter.
|
|
|
|
Smartvirus
Legendary
Offline
Activity: 1498
Merit: 1137
|
|
September 08, 2021, 07:24:39 PM |
|
Omo this proverb dey to tori my brain, make me self drop my own for una Proverb If wall no open, wizard no go enter.
Omo, this your proverb make sense o, I don dey reason am since but, the thing no wan gree enter, as in the literal meaning for the life. E go still sure wella if you help me throw small meaning make my head no for burst. Where you dey since cef, you be like correct guy o and you do well say, you don come locate this our small corner. Na so we dey do am for hear o, make we for dey try preserve our heritage. Very soon cef eh, we go store am for blockchain, lol... Anyhow shah, you dey very welcomed for this our corner, try join body with us make we for know you wella, una weldon.
|
|
|
|
Rruchi man
Legendary
Offline
Activity: 1358
Merit: 1097
Bitcoin Casino Est. 2013
|
|
September 09, 2021, 06:21:10 AM |
|
Omo @Mpamaegbu, na so I for carry miss you for this we corner o but, God dey shah and this one show say, you na real man of the people with the way people come out con voltage for you. I just get joy say, you d0n show back to join body with me make we dey carry this our corner dey go, na you be the ginger for here and me no for fit do am alone. Oya o, one proverb turn up for we matter...
E sweet me o brother, say them dun pour cold water on top the matter ooo...i dun dey reason say how this place wan take dey without our correct Mpamaegbu, e for quick tire country man. Welcome back. As God take sharp sharp tidy your case, na so e go run poka own too, IJN. If wall no open, wizard no go enter.
Welcome oooo brother, as you carry leg waka reach this our corner, na so good thing go dey waka come your side, wetin you go take, we get Kola, we get garden egg & Osoji(groundnut paste), we even have freshly tapped palm wine, just make your choice o, person go bring am come now now. I been wan ask one question for your proverb - Na wizard you been wan type, abi na lizard? Which one?
|
| | | | | | | ███▄▀██▄▄ ░░▄████▄▀████ ▄▄▄ ░░████▄▄▄▄░░█▀▀ ███ ██████▄▄▀█▌ ░▄░░███▀████ ░▐█░░███░██▄▄ ░░▄▀░████▄▄▄▀█ ░█░▄███▀████ ▐█ ▀▄▄███▀▄██▄ ░░▄██▌░░██▀ ░▐█▀████ ▀██ ░░█▌██████ ▀▀██▄ ░░▀███ | | ▄▄██▀▄███ ▄▄▄████▀▄████▄░░ ▀▀█░░▄▄▄▄████░░ ▐█▀▄▄█████████ ████▀███░░▄░ ▄▄██░███░░█▌░ █▀▄▄▄████░▀▄░░ █▌████▀███▄░█░ ▄██▄▀███▄▄▀ ▀██░░▐██▄░░ ██▀████▀█▌░ ▄██▀▀██████▐█░░ ███▀░░ | | | | |
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary
Offline
Activity: 2758
Merit: 1226
Once a man, twice a child!
|
|
September 09, 2021, 10:27:05 PM Merited by Rruchi man (1) |
|
Omo this proverb dey to tori my brain, make me self drop my own for una Proverb If wall no open, wizard no go enter.
I nor know whether you don see dis thread wey dem post about you for plagiarism here https://bitcointalk.org/index.php?topic=1926895.msg57886867#msg57886867Smartvirus and Rruchi my brodas, nor be small thing oh. But we thank Baba God sey everi everi don calm down now.
|
Before you boast of your material acquisition, take a stroll to a morgue and there you will find those who were once better than you're. Only fools think they've it all. Stay humble 🤔
[/color]
|
|
|
Davidvictorson
|
|
September 10, 2021, 02:12:49 PM |
|
Proverb: Pikin when Dey find party rice, nor suppose to fear dance Meaning: One must not be afraid to make the necessary sacrifice to be successful.
Proverb: Fight wey you no fit fight for night no start am for day time. Meaning: Don’t go about looking for trouble is you can’t sustain it.
Proverb: Our beans go don Meaning: Everyone will be successful it’s only a matter of time.
|
|
|
|
XCANA
|
|
September 10, 2021, 09:00:03 PM |
|
Igbo Proverb: E were otu okuko chuoru arusi abua aja, ha egbuo mmadu mezuo ya.
" When a single fowl is sacrificed to two deities, they'll kill two humans to complete the offer".
Meaning: Do not apply shortcut to the things of great importance; the repercussion maybe deadly!
|
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary
Offline
Activity: 2758
Merit: 1226
Once a man, twice a child!
|
|
September 11, 2021, 05:38:10 AM |
|
Davidvictorson, I welcome you with two hands as you enta dis corner. Na correct thing wey you do as we go dey rub minds dey go. Your proverb make sense but e don already tanda here before 👇 Pikin wey wan chop party rice, e nor dey fear dance. Meaning: To succeed in life you really don't have to care about negative comments from people.
@XCANA, I salute you too bro. Una welcome. I suppose give una colele wata drink but e neva dey my fridge now.
|
Before you boast of your material acquisition, take a stroll to a morgue and there you will find those who were once better than you're. Only fools think they've it all. Stay humble 🤔
[/color]
|
|
|
Smartvirus
Legendary
Offline
Activity: 1498
Merit: 1137
|
|
September 14, 2021, 10:20:47 PM |
|
Igbo Proverb: E were otu okuko chuoru arusi abua aja, ha egbuo mmadu mezuo ya.
" When a single fowl is sacrificed to two deities, they'll kill two humans to complete the offer".
Meaning: Do not apply shortcut to the things of great importance; the repercussion maybe deadly!
Guyyyyyyyyy, guy you good. Chow, this one hit me for somewhere, real matter o. The proverb too go and e ethical die. Omo, I go like dey see more and more from you @XCANA, you good. Oya na, make I drop one. Proverb In pighin: them say, rain maker way go wait for rain to drop before e go spit for outside, no sabi the work. In English: A rain maker that waits on the rain to drizzle before spitting out, isn't good at the job Meaning: prevention is better than cure. You don't wait until it becomes serious before taking the first step. Una way new for here, we welcome una, make una flex, na we get am!
|
|
|
|
Davidvictorson
|
|
September 17, 2021, 10:02:40 PM |
|
Davidvictorson, I welcome you with two hands as you enta dis corner. Na correct thing wey you do as we go dey rub minds dey go. Your proverb make sense but e don already tanda here before 👇 Pikin wey wan chop party rice, e nor dey fear dance. Meaning: To succeed in life you really don't have to care about negative comments from people.
@XCANA, I salute you too bro. Una welcome. I suppose give una colele wata drink but e neva dey my fridge now. Ewoo eh , I no sabi say e don dey here. No Vex. Make I replace am with this one 👇 PIDGIN: Person wey want something na him hand dey long passENGLISH: What you are looking for is not in your comfort zone. You have to move out to get it.
|
|
|
|
|