Proverb: Picture better pass thousands of words.
Meaning: An image can tell a better story than words.
Dis one enter me well, I remember back in the days when dem dey use drawing dey teach us plenty tins I bin dey understand tins faster dat time I still remember when my uncle been dey teach me tins with drawing book e help me to fit remember tins easily because once my mind go wia the pictures dey I go come recall wetin dem been teach me.
E get some things wey we need make them tell us in words dan or pictures dis one depend on how deep the thing be you no say words dey change person mind so if you show person wey dey blind picture em no go no wetin you dey show am but if you tell am word em go flow faster with you.
No be lie my broda, pictures dy make pikin recall past evemor something wey dem teach dem for school pass wen you dey read book without picture, e dy hard to recall.
Proverb: Every good things must come to an end one-day.
Meaning: Good times don't last for ever.
Make una add something different abeg.