|
Futurexxx
|
 |
October 11, 2026, 04:53:36 PM |
|
My country people, how ona dy na? I hope everyone dey alright inside this evening. Today I just say make I visit this thread and knack one parable wey been don dey my mind since, and the parable goes like this If you see any farmer wey wan sell pregnant goat for market, just know say the problem for him house get e bigger belle than the goat.
Meaning: when you see someone making a painful and unexpected decision, just know that their may be a problem heavier than you can imagine, that he needs to address, so judging people without knowing the full story is not the best.
|
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary

Activity: 3612
Merit: 1317
Once a man...Twice a child!
|
 |
October 12, 2026, 04:10:02 PM |
|
If you see any farmer wey wan sell pregnant goat for market, just know say the problem for him house get e bigger belle than the goat.
Nor bi lie. Anoda yarn wey resemble dat wan na, "wen persin sey wetin big pass im farm, e go sell im barn." Awa prayer na make wetin big pass us nor locate us at all, at all.
|
|
|
|
|
danieldavidd
Jr. Member

Activity: 106
Merit: 4
|
 |
October 15, 2026, 02:25:01 PM |
|
Any rat wey get mind chop rat food him no go get rest of mind to stay one place. Meaning any savant that offend his master will be under pressure while him staying in one place.
No matter how you throw stone reach up him come down by himself. Which means in life what goes around will surely comes around.
|
|
|
|
|
|
Majestic-milf
|
 |
October 19, 2026, 02:12:02 PM |
|
Omo e don tey wey I show for this area and I no go lie I don miss to chook mouth here but I dey avoid to come put mouth wen I no get better Proverbs for mouth. I see this one and I say make I come drop am here as I feel say this thing nah wetin we dey experience for the world at large and country in particular.
Proverbs: The grass dey see the zebra as e enemy and the lion as e friend Meaning: you fit dey see person as the villain make another person view am as e savior.. Some people prefer to choose the greater evil just because them dey benefit from am over the person wey good. Una fit add una own oh. I greet una!!
|
|
|
|
|
|
Jessie2121
|
 |
October 19, 2026, 02:48:45 PM |
|
Omo e don tey wey I show for this area and I no go lie I don miss to chook mouth here but I dey avoid to come put mouth wen I no get better Proverbs for mouth. I see this one and I say make I come drop am here as I feel say this thing nah wetin we dey experience for the world at large and country in particular.
Proverbs: The grass dey see the zebra as e enemy and the lion as e friend Meaning: you fit dey see person as the villain make another person view am as e savior.. Some people prefer to choose the greater evil just because them dey benefit from am over the person wey good. Una fit add una own oh. I greet una!!
This one na another example of one man's meat is another man's poison, e sweet for ear abeg. This your proverb remind me of how we as humans dey live our lives, we go dey talk evil about another person but for another side people dey wey dey praise and love that particular person, my question na, why life gat to dey like that self? Na wa oh.
|
|
|
|
Apex_1
Newbie

Activity: 41
Merit: 0
|
 |
November 04, 2026, 08:42:45 AM |
|
PROVERBS: Pekin way say him mother no go sleep for night, that pekin self no go sleep.
MEANING: A child who refuses to respect and ignore the advice of his/her parents, that child will not see success in life.
|
|
|
|
|
Jettismonroe
Newbie

Activity: 7
Merit: 0
|
 |
November 05, 2026, 10:30:43 AM |
|
Proverb: Na person wey wear shoe, know where e dey pain am. Meaning: It's only a person experiencing or going through a particular problem knows exactly how it hurts.
|
|
|
|
|
Iconic_J
Newbie

Activity: 28
Merit: 0
|
 |
November 05, 2026, 11:06:05 AM |
|
Proverb: You fit carry the goat away from the bush, but you no fit commot the bush from the goat Meaning: You can change your environment but your mindset can still remain the same.
|
|
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary

Activity: 3612
Merit: 1317
Once a man...Twice a child!
|
 |
November 05, 2026, 01:41:01 PM |
|
Proverb: You fit carry the goat away from the bush, but you no fit commot the bush from the goat Meaning: You can change your environment but your mindset can still remain the same.
Dis proverb don enter goat matta? Na pig I sabi wey we dey use am for. Anyway, nothing spoil.
|
|
|
|
|
|
Barikui1
|
 |
November 12, 2026, 08:23:57 AM |
|
Greetings my country people. Today I just say make I drop on African parable wey don dy my mind since, although e no too make sense oo, but at least the message they very plain and clear.
proverb: When the lions is the only barber in the village, don't blame the goat for keeping afro.
Meaning:
If the only person wey go fit help you, go fit also harm you in the process, no need to blame you if you refuses the help.
Goat no keep afro because him like afro, e keep am because e no wan die as him dy barb hair.
So no blame victim, blame the dangerous option.
|
| █▄ | R |
▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄ ████████████████ ▀▀▀▀█████▀▀▀█████ ████████▌███▐████ ▄▄▄▄█████▄▄▄█████ ████████████████ ▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀ | LLBIT | ▀█ | THE #1 SOLANA CASINO | ████████████▄ ▀▀██████▀▀███ ██▄▄▀▀▄▄█████ █████████████ █████████████ ███▀█████████ ▀▄▄██████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ █████████████ ████████████▀ | ████████████▄ ▀▀▀▀▀▀▀██████ █████████████ ▄████████████ ██▄██████████ ████▄████████ █████████████ █░▀▀█████████ ▀▀███████████ █████▄███████ ████▀▄▀██████ ▄▄▄▄▄▄▄██████ ████████████▀ | ........5,000+........ GAMES ......INSTANT...... WITHDRAWALS | ..........HUGE.......... REWARDS ............VIP............ PROGRAM | . PLAY NOW |
|
|
|
Mpamaegbu (OP)
Legendary

Activity: 3612
Merit: 1317
Once a man...Twice a child!
|
 |
November 13, 2026, 11:53:40 AM |
|
If the only person wey go fit help you, go fit also harm you in the process, no need to blame you if you refuses the help.
Nor bi lie, I tell u. Dis ur comment even don remind me of wan thread for d oda forum on dis same issue of refusing help from people.
|
|
|
|
|
RealNoblee
Member


Activity: 212
Merit: 29
|
 |
November 14, 2026, 07:33:41 PM |
|
Na rat wey dey house dey tell the rat wey dey outside sey fish dey for pot.
Your secrets are always revealed by those closest to you.
|
|
|
|
|
|