I hear rumour say Buhari dey do everything possible to make sure Tinubu no take over from am and he dey use frustrating of the country use set the pass. You know Nigeria na party wey dem sabi before Obi come and changed everything. So e belike Buhari dey use this streets use make us hate the APC government entirely. You reason am na, how dem go make everything dis difficult when them know say e go affect their performance for poll.
Even tinubu self know say the current occupant of Aso Rock no like am and his entourage dun make dat comment before, he wasn't their candidate as they wanted a younger person to take over from bubu. The last time self wey tinubu do rally, he threw some shuts at Buhari. If this turns out to be true then maybe Buhari meant well for the country after all.
Bro... I have thought about this too. Aside being sick and old, Tinubu is one of the most corrupt politician in Nigeria. The guy just hold Lagos ransom, put him people for big positions wey dey monitor and control lagos resources back to him even when he's no more governing. Buhari knows this and him go don reason am say if this guy fit do this kind thing to Lagos imagine wetin him go to Nigeria if him be president. E fit wan buy the hearts of majority of the lawmakers for national assembly and try to change the constitution to favour am.
From Buhari's body language, it obvious he does not support Tinubu and he's being neutral or trying to ensure that INEC conducts a free and fair election through the introduction of BVAS and naira redesign.