Original Topic: FAQ: Everything you need to know about forum 'activity, account ranks and meritAuthor: hilariousandco
D way dem dey calculate activity is too hard to understand, but I go put am in simple way for una
U go fit get only 14 activity points every two week period. Na dis bi d basic things u suppose know but I go explain all d small details and hard parts including how d system dey operate down here so dat people no go dey confuse again:
★ U go only get 14 activity points in every 2 weeks period.
★ Dem dey fix d 2 weeks periods, but e no dey immediately u sign up.
★ U go fit find d list wey contain all d dates for d activity periods on dis link wey dey here
spreadsheet (Make we give d three gboosa to
jambola2 for arranging and putting am together ).
★ U fit get more than 14 activity within two weeks if u sign up between periods.
★ Wettin u need to do bi say, u go make at least one post for each activity period so dat u go fit collect d activity another time. For example, u fit make one post for three different periods, and den u go get 3 posts and 3 activity, but a potential activity of 42. Once u do d 42 posts then u go get 42 activity but e no go dey more than dat. If u do one post for 35 different periods, then u go get 35 posts and 35 activity but a potential activity of 480. Dis means say u go be a Junior Member but if u do d complete 480 posts u go upgrade to Hero Member immediately.
★ If your post count surpass your activity by 14 or more than 14 then u go only need to do one post for d new period so dat u go fit get d full 14 activity. For example, your post count na 200 but your activity na only 28. To get another 14 activity u go only make one post for d new period and then u go get a total of 42 activity.
Ranks and activity:Brand New: 0 posts
Newbie: 1-29 activity
Jr. Member: 30-59 activity
Member: 60-119 activity
Full Member: 120-239 activity
Sr. Member: 240-479 activity
Hero Member: 480 activity
Legendary: Somewhere between 775 and 1030 activity
Merit:In addition to Activity u go also need Merit to achieve each rank.
D merit wey u go need, dey break am down blow here:
Brand new: 0
Newbie: 0
Jr Member: 1
Member: 10
Full Member: 100
Sr. Member: 250
Hero Member: 500
Legendary: 1000
dis is a table for the activity periods and time wey e go take u to get each rank:1 X 14 = 14
2 X 14 = 28
3 X 14 = 42 --- Junior. Member (1.5 month)
4 X 14 = 56
5 X 14 = 70 --- Member (2.5 month)
6 X 14 = 84
7 X 14 = 98
8 X 14 = 112
9 X 14 = 126 --- Full Member (4.5 month)
10 X 14 = 140
11 X 14 = 154
12 X 14 = 168
13 X 14 = 182
14 X 14 = 196
15 X 14 = 210
16 X 14 = 224
17 X 14 = 238
18 X 14 = 252 --- Senior Member (8.5 month)
19 X 14 = 266
20 X 14 = 280
21 X 14 = 294
22 X 14 = 308
23 X 14 = 322
24 X 14 = 336
25 X 14 = 350
26 X 14 = 364
27 X 14 = 378
28 X 14 = 392
29 X 14 = 406
30 X 14 = 420
31 X 14 = 434
32 X 14 = 448
33 X 14 = 462
34 X 14 = 476
35 X 14 = 490 ---- Hero Member (1.3 years)
36 X 14 = 504
37 X 14 = 518
38 X 14 = 532
39 X 14 = 546
40 X 14 = 560
41 X 14 = 574
42 X 14 = 588
43 X 14 = 602
44 X 14 = 616
45 X 14 = 630
46 X 14 = 644
47 X 14 = 658
48 X 14 = 672
49 X 14 = 686
50 X 14 = 700
51 X 14 = 714
52 X 14 = 728
53 X 14 = 742
54 X 14 = 756
55 X 14 = 770
56 X 14 = 784 --- Legendary rank (2 years)
-------------------Activity FAQ:Why my activity con stuck for one place/and e no dey move?Because na only only 14 activity u fit get every two week period. U go just wait small until d next period begin so dat u go get another 14.
Why has my rank/activity never updated?E go fit take up to an hour before e go update. Make u just dey patient.
My activity or my rank fit reduce?Yes. E go only fit reduce wen u delete
all d posts wey u do from a particular period or d threads wey u posted for dustbin. E dey possible for u to drop rank until u get enough activity again.
I fit get more than 14 activity within two week period?No. But as e dey bi, e dey possible for u to get more than 14 activity in 2 weeks if you sign up in between periods, but no go fit get more than 14 activity in 2 weeks period. For example, if d period starts on a Wednesday and u sign up on Tuesday u go fit get 14 points on Tuesday and another 14 on Wednesday if d period don already start. Then u go get 28 activity points but u no get any activity points again until in two weeks' time wen d new period start.
Wettin go happens if I miss a period?Nothing. But u no go get dat activity and u don miss dat activity forever. Just make sure say u post for d next period so dat u go fit get another 14.
Why I no go fit change my avatar?Until u don reach Full Member upward before u go fit have an avatar.
Wen I go become Legendary?U go become Legendary randomly somewhere between 775 and 1030 activity.
Does e mean say time wey I dey spent online count towards activity?No. E no dey count towards anything, in fact na meaningless statistic.
Do only certain boards or posts suppose bi a minimum character length before e go count for activity?No. All boards and posts of all length dey currently count towards both.
If I create an account and leave am for some time I go fit become a higher rank when I come back?No. U go still dey for newbie rank. Activity dey measures how
active you dey dey on the forum and na to prevent against lazy account farming. If u no dey do at least one post for each period den u no go get dat activity.
Why I no go fit post photos?Because u suppose bi a Junior Member before u go fit do that. For u to become a Junior Member u have to dey post for three activity periods and get at least 28 activity. But as e dey bi, you fit cross dis rules by buying a Copper Membership for a small fee
here.
-------------------Merit FAQ:Wettin be Merit?Merit na new system wey dem create to they reward people wey make quality contributions to the forum. Now if u wan rise through ranks u go also need to get Merit apart from the Activity.
How I go receive merit?Na from d people of d community u go dey receive merit award if dem find your post helpful or informative.
How I go dey send Merit?Dem get a +Merit button at d top right of every post. If u wan dash someone merit make u just click on d botton and follow the instructions.
Wetting bi d difference between Merit and sMerit? Na two types of merit we get. U no go fit send your merits, na only your sMerit u go dey send. For every Merit wey u receive u go get 0.5 spendable merit to reward d posts wey u think say deserve merit.
I fit ask for merit?There is no need to do dat, because we dey see dis kind behaviour as 'merit begging' which d community members no dey like at all and e fit cost u to receive negative feedback. Just continue to dey make quality, constructive posts and u go surely get rewarded over time.
I fit sell merit?Selling merit is not allowed.
I fit give merit to my alt accounts?No, dem no dey permit dat and e fit cost u to receive negative feedback if dem find out.
Can I be demerited or lose merit?No, not currently. Even if dey remove your post d merit go still dey.
Wettin bi a merit source?Dem get certain number of special Merit sources who dey receive additional amounts of merit to give away. D list no dey popular, but d staff know am.
How I go fit become a merit source?As per theymos' instructions:
If u wan bi a merit source:
1. Be a member wey get more experience for the forum.
2. We go collect TEN posts wey u write in d last couple of months wey never get nearly enough merit for how good dem bi, and post quotes for dem all in a new Meta thread.
3. We go take a look at your history and maybe make you a source.
Dey get limit for how many merits I go dey fit send?Yes. U go fit give a max of 50 merit to a user every 30 days.
Merit stats:
https://bitcointalk.org/index.php?action=merit;statsNote: Abeg make una no say unnecessary 'thanks for d info' as well as any questions wey we don already answered or explained, because we go remove am, na only posts una go type for here. Abeg report any threads wey ask questions wey dey don already answered here because dey no dey necessary and we go remove am. Thanks.
na AOBT na run dis Translation by Dem self