Rruchi man
|
 |
November 24, 2022, 07:42:31 AM |
|
For me, I nor see anything wrong with the new redesign sha.
Same here, all the talk about say the money nor fine, the colour nor go well no matter, the main thing na say make person get the money, e go dey fine for spending. Even as una dey talk say e nor fine, e nor get wetin una go still do last last, you go still use am like that till e go fine for una eyes. Kif you say because you nor like the colour, say you nor go use am...Na Shege you go see, not just Sapa. The focus should remain getting this money in abundance. Also you will find out that this new currency design is being printed in Nigeria and not outside the country. the redesigned currencies are locally produced by the Nigerian Security Printing and Minting (NSPM) PLC. source
|
|
|
|
|
|
Advertised sites are not endorsed by the Bitcoin Forum. They may be unsafe, untrustworthy, or illegal in your jurisdiction.
|
|
|
|
Agbe
Sr. Member
  
Offline
Activity: 462
Merit: 1019
Bisq Market Day - March 20th 2023
|
 |
November 24, 2022, 10:35:56 AM Last edit: November 24, 2022, 10:47:59 AM by Agbe |
|
DaNNy001 and uchegod-21 your quotations are wrong, so you can re-edit it before another person also quote it wrongly. The redesigning of the Naira is not a problem in Nigeria, but the problem in Nigeria is the price of goods and services. If any government can reduce the prices of goods and services and also create Enabling environment for the Citizens and the foreign investors then everything will be ok in the country. That is why some people are saying that they should approve the use of coins either on paper or on the normal coin. To save Nigerian economy is to accept the payment of 1 Kobo to #1, and to #50 massively than #100 to #1000
|
|
|
|
Cryptomultiplier
|
 |
November 24, 2022, 12:41:50 PM |
|
NEW TOPIC: History as Buhari Supervises Crude Oil Drilling in the NorthFor the first time in history, President Muhammadu Buhari is expected to officially kick off the drilling of crude oil in the north on Tuesday, about two years after the mineral resource was discovered in the region. This is a major boost to the efforts by the federal government to ensure that the region produces crude oil in commercial quantities.Specifically, the president will conduct the ground-breaking ceremony of the Kolmani Oil Prospecting Lease (OPL) 809 and 810 at the Kolmani field site located in Bauchi and Gombe states. The president is expected to carry out the historic exercise with the support of the Minister of State for Petroleum, Mr. Timipre Sylva and the Group Chief Executive Officer of the Nigerian National Petroleum Company Limited (NNPC), Mallam Mele Kyari, among others, THISDAY gathered.It was further learnt that the oilfields in Bauchi and Gombe states will be developed by Sterling Global Oil, New Nigeria Development Commission (NNDC) and the NNPC Limited. “The ceremony will be held on Tuesday, November 22, and will be attended by Mr. President himself together with most of his cabinet members including... Read more: https://www.thisdaylive.com/index.php/2022/11/20/history-as-buhari-supervises-crude-oil-drilling-in-the-north/I dey happy as dey dun find oil for the north and maybe now our northerner leader go fit agreed to the terms of giving every state their independence. I seriously they wish this discover to dey successful so the North for face their own national resources and commot eye for the south own. I believe say this new development go strength the country economy and fit reduced the fuel spike in price and scarcity wey we dey get. You no say the north get well industrial men wey go run better refinery for them and e go dey successful unlike wetin we dey experience for the south. Sha wetin you dey think of this new discovery and how e go affect the counter both positively and negatively?. I been dey very happy when I learnt about this discovery. President Buhari don use this one as an important achievement before him comot for office. At least the south can be allowed to enjoy its resources thereby creating abundance of petroleum products with hopes say the prices go dey reduced. New job openings too, only if they intend to use nationals and not foreigners. The oil refineries and other oil infrastructures will be developed/built to accommodate this discovery and am seeing less monopolization or hording of its products because it will be in abundance, hopefully.
|
|
|
|
Coyster
Legendary
Offline
Activity: 1596
Merit: 1129
'Life's but a walking shadow'!
|
 |
November 24, 2022, 03:16:42 PM |
|
To be honest I have little or no knowledge about crypto currency, though I participated in a few airdrops like meta war and pi, no of them worked out sha that's why I'm actually here.so my people, help me out. How do I get merits, how often do I need to post, how long does my post have to be, how can I be sure to get engagements. I still have a lot of questions but let's just start with these. Abeg I really need help here I feel like I don't know what I'm doing .
Welcome mate, quite a lot of us started with zero knowledge of cryptocurrencies, no man was born with any knowledge at all, but if person they consistent and persistent say im wan learn something, then the knowledge of that thing would definitely come to him. Forget about airdrops my brother, just concentrate on Bitcoin, use this forum take garner knowledge, just ask questions wey go help you develop your knowledge and users in the forum as well as this local community go help you out with the answers. Having said that, no too reason merit as you just start, once knowledge choke for your side, merit go follow am. You should post as often as you want to, that one they up to you, but as you be new user so, reading is most important than posting. Your posts can be of any length at all, it is up to you, and if you want make your new threads get engagements, then the post must make sense, if not people go vex they put you on ignore. Welcome brother, just relax, everything go clear for your eye with time.
|
|
|
|
Marykeller
|
 |
November 24, 2022, 08:13:34 PM Last edit: November 24, 2022, 08:25:33 PM by Marykeller |
|
purpose of this redesign is to reduce the money in circulation and strength the economy. No be to make am look finer. Abeg we need to be supportive if we really want development for this our country. Truth is bitter jare.
We know the purpose of redesigning the naira notes but em d too ridiculous say the CBN no fit come up with better redesigning, if no be just filter redesigning naira notes. If you look at the dollar notes wey you uploaded, there's a bit creativity for dollar note compared the old one and the new one. But for our case no creativity or craft d am inside. Na just filter blue color d apply on am Em no b bad thing if we get this kind creativity for our naira note  See wetin peso fit come up with, within 1hr 30minutes. So CBN no get peso wey go just redesign our naira to make it more beautiful as this one dey so. This redesigning of naira notes the exact way it is no bam atal. No sound as if the filter CBN apply give make sense. This na wetin majority of Nigerians the castigate about. No just talk sae we suppose like am without talking about am
|
|
|
|
Frankolala
Sr. Member
  
Offline
Activity: 280
Merit: 256
#on God
|
 |
November 24, 2022, 08:36:14 PM |
|
purpose of this redesign is to reduce the money in circulation and strength the economy. No be to make am look finer. Abeg we need to be supportive if we really want development for this our country. Truth is bitter jare.
We know the purpose of redesigning the naira notes but em d too ridiculous say the CBN no fit come up with better redesigning, if no be just filter redesigning naira notes. If you look at the dollar notes wey you uploaded, there's a bit creativity for dollar note compared the old one and the new one. But for our case no creativity or craft d am inside. Na just filter blue color d apply on am Em no b bad thing if we get this kind creativity for our naira note  See wetin peso fit come up with, within 1hr 30minutes. So CBN no get peso wey go just redesign our naira to make it more beautiful as this one dey so. This redesigning of naira notes the exact way it is no bam atal. No sound as if the filter CBN apply give make sense. This na wetin majority of Nigerians the castigate about. No just talk sae we suppose like am without talking about am Wetin dey vex me pass be say them dey lie say na 8billion naira na e dem use do rebrand for where that one dey happen, make them give us statistics how them spend am. See the yeye thing wey dem do just to thief our money through a legal way. I know say this rebranding go help strengthen the currency but at the same time e no fit remove corruption or poverty. Eight billion we dem use if them use am for project for we country to benefit from na bad thing. OK make person tell me how this rebranding go take benefit the common man like me and you for this country. The problem with Nigeria leaders be say anything we them dey do na for a purpose to favor themselves or to choke their rival. I believe say this rebrand na to choke their enemies for this forth coming election and to also get means to print and steal our money o. Nigeria needs leaders wey go fit tackle serious problems wey dey affect the country no be to go dey rebrand money.
|
|
|
|
Majestic-milf
Sr. Member
  
Offline
Activity: 378
Merit: 306
Get Flush at flush.com
|
 |
November 25, 2022, 02:08:47 AM |
|
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value on a daily. Sombodi say wetin e go profit the naira if e gain all the redesign and lose e value?
As it is, the power to change all these confused geriatrics from power na with our vote. Imagine person go dey whine me say e use not #8bn as was meant to believe but #218bn just to achieve a bunch of turd. So e go beta if we all calm down and think if ways to make the contri beta.
|
█▀▀▀ █ █ █ █ █ █ █ █ █ █ █ █▄▄▄ | | ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ Flush.com..■■■ ■■ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ | | | | | | | | ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ■ ■■ ■■ PLAY NOW ■ ■ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ | ▀▀▀█ █ █ █ █ █ █ █ █ █ █ █ ▄▄▄█ |
|
|
|
EarnOnVictor
|
 |
November 25, 2022, 07:22:11 AM |
|
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value on a daily. Sombodi say wetin e go profit the naira if e gain all the redesign and lose e value?
As it is, the power to change all these confused geriatrics from power na with our vote. Imagine person go dey whine me say e use not #8bn as was meant to believe but #218bn just to achieve a bunch of turd. So e go beta if we all calm down and think if ways to make the contri beta.
People neva start to dey para, e go soon happen if things dey go like dis. Everything 4 naija na shame and d old bunch of leaders wey we get no go tire or let beta people reach there if people no do something. APC get nothing right 4 their 8 years reign, no be even d mere redesigning of naira note. D thing be like photocopy 4 my eye, photocopy wey dem con mix with colour. This is shameful! I wonder how dem go dey feel if oyinbo people con Naija con dey spend the photocopy...lol. Seriously, I tire 4 dis country.
|
|
|
|
RockBell
|
 |
November 25, 2022, 07:36:17 AM |
|
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value on a daily. Sombodi say wetin e go profit the naira if e gain all the redesign and lose e value?
As it is, the power to change all these confused geriatrics from power na with our vote. Imagine person go dey whine me say e use not #8bn as was meant to believe but #218bn just to achieve a bunch of turd. So e go beta if we all calm down and think if ways to make the contri beta.
People neva start to dey para, e go soon happen if things dey go like dis. Everything 4 naija na shame and d old bunch of leaders wey we get no go tire or let beta people reach there if people no do something. APC get nothing right 4 their 8 years reign, no be even d mere redesigning of naira note. D thing be like photocopy 4 my eye, photocopy wey dem con mix with colour. This is shameful! I wonder how dem go dey feel if oyinbo people con Naija con dey spend the photocopy...lol. Seriously, I tire 4 dis country. According to our leaders their intention no be to redesign per say , but say their intention na to bring out money wey people done hide, so that it will be in circulation, as me I see the color of money I was like what is this if that is truly their motive not bad at all because money wey people don hide no be small oh my brother so make we try look this thing for another dimension, and CBN have lifted all deposit charges so abeg if una get old money make we try carry them go bank.
|
|
|
|
Maestro75
Sr. Member
  
Offline
Activity: 1666
Merit: 267
Bisq Market Day - March 20th 2023
|
 |
November 25, 2022, 08:12:11 AM |
|
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes.
Me no follow para o, naira abeg take note. If e gree you, make you avoid the hones of those weh deh para for you to avoid wotowoto. Make them no use vex begin tear you apart. Come to my house and stay. Na two friendly hands me and my household want take welcome you. You be senior man, o naira! Na my love letter be that to naira.
|
|
|
|
Obari
Full Member
 
Offline
Activity: 182
Merit: 166
Let's help touch the lives around us with love.
|
 |
November 25, 2022, 09:08:54 AM |
|
Hey guys I'm a newbie Username: Pillsike Gender: male State or residence: Abia state To be honest I have little or no knowledge about crypto currency, though I participated in a few airdrops like meta war and pi, no of them worked out sha that's why I'm actually here.so my people, help me out. How do I get merits, how often do I need to post, how long does my post have to be, how can I be sure to get engagements. I still have a lot of questions but let's just start with these. Abeg I really need help here I feel like I don't know what I'm doing .
Welcome on board mate and one thing you go know be say nothing good comes easy and you gats to work. No too stress yourself but rather dey see the forum as a get together and a forum wey all your crypto issues fit dey possibly solved. I know say everybody dey actually find merit but the truth be say, people go easily merit you when you talk something wey touch their heart. Even me I still dey new for here but I no go lie say God no dey try for me and you just need to comot your mind for merit and try as much as possible to make post wey even if you na you wan merit am, you fit get mind give better merit
|
|
|
|
uchegod-21
Sr. Member
  
Offline
Activity: 518
Merit: 451
For campaign, Pm CryptopreneurBrainboss
|
 |
November 25, 2022, 05:30:42 PM |
|
purpose of this redesign is to reduce the money in circulation and strength the economy. No be to make am look finer. Abeg we need to be supportive if we really want development for this our country. Truth is bitter jare.
We know the purpose of redesigning the naira notes but em d too ridiculous say the CBN no fit come up with better redesigning, if no be just filter redesigning naira notes. If you look at the dollar notes wey you uploaded, there's a bit creativity for dollar note compared the old one and the new one. But for our case no creativity or craft d am inside. Na just filter blue color d apply on am Em no b bad thing if we get this kind creativity for our naira note  See wetin peso fit come up with, within 1hr 30minutes. So CBN no get peso wey go just redesign our naira to make it more beautiful as this one dey so. This redesigning of naira notes the exact way it is no bam atal. No sound as if the filter CBN apply give make sense. This na wetin majority of Nigerians the castigate about. No just talk sae we suppose like am without talking about am Wetin you mean by creativity? Na for ontop Naira note Nigerians wan show their creativity? We Nigerians too dey pick up fight where fight no dey, we too dey pick up talk where talk no dey. Na wetin make Government too dey use us and see us as mumu. Small thing we go happen, Nigerians go carry their whole mind and attention put like people wey no get job. If Ned Nwoko marry another wife, e go trend for 3 months, if Yul Edochi marry another wife, e go trend for 3 months, haba! If naira fall to N900 to $1 we no longer care because the design of naira good? If government needed best designs, dem for do talent hunt and give everyone opportunity to design. Meanwhile, for preservation of the identity of our legal tender, new notes are not supposed to look totally different from old ones.
|
|
|
|
|
Frankolala
Sr. Member
  
Offline
Activity: 280
Merit: 256
#on God
|
 |
November 25, 2022, 07:26:58 PM |
|
Dis na good news for us na now I believe say government don finally accept crypto for we country for them to come up with this initiative. E make sense well well at least na opportunity for people we won learn about blockchain to get the knowledge and skill. I hope say all these no be disguise because of election because this Buhari government no straight o,I hope say this scholarship go be open floor no be the one wey this government men go pack all the slots give dem children or their relations so that make only dem enjoy Nigeria funds.
|
|
|
|
BIT-BENDER
|
 |
November 25, 2022, 08:34:48 PM |
|
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value
I greet you my brother, when I first hear the story about central bank of Nigeria wanting to release a new design on the 200, 500, 1000 naira note, I no see am as necessary till I learnt that part of their reasons na because too many of the currency Dey circulation and away from banks, and money launderers and them kind don Dey save the money away from banks. And when the redesign come out I also no too reason even if e Dey obvious that nothing much was done on the design but Wetin Dey mad me be the amount of money them claim say them use to run the redesign mata. My people make we wise up.
|
|
|
|
CryptopreneurBrainboss (OP)
Legendary
Offline
Activity: 1834
Merit: 3256
There's no death only a better place than earth...
|
 |
November 25, 2022, 09:08:26 PM |
|
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value on a daily. Sombodi say wetin e go profit the naira if e gain all the redesign and lose e value?
You see me para? Nothing concern me with how Naira dey color. Infact I dey accept all colors as normally I no dey discriminate (I no be racist) all colors matas even though na black dem wan do am. We still dey game, we go dey chase the bag until we get that bag wey go make the paper begin chase us back. Wetin dun happen dun happen na to move on as protest no dey work for this country. Normally if na outside and the citizens no like any new development dem go enter street go protest and something urgent will be done about it. Our own na to shoot us dem sabi. How much self dem carry design this thing but sha wetin we go do, nobi today dem begin thief the national cake. All of dem na the same thing, no surprise them all go shift go labour party or make obi defeat go majority party if him try win and the corruption continues. Cartel man dey wey dey run this country, all this one wey we dey see for front na just film. Every election tym na so dem get one person wey dem go paint as the saviour but as usual nothing come out.
|
|
|
|
Igebotz
aka igehhh
Legendary
Offline
Activity: 966
Merit: 1253
Rosicrucian 🌹Let's die today!
|
 |
November 25, 2022, 09:16:20 PM |
|
Omo, like dis everybody dey para for the redesigned naira notes. But wetin I Kno be say wetin don happen don happen. We dey lament say we govt corrupt and all that, but e no go change the fact say the naira dey lose value
I greet you my brother, when I first hear the story about central bank of Nigeria wanting to release a new design on the 200, 500, 1000 naira note, I no see am as necessary till I learnt that part of their reasons na because too many of the currency Dey circulation and away from banks, and money launderers and them kind don Dey save the money away from banks. And when the redesign come out I also no too reason even if e Dey obvious that nothing much was done on the design but Wetin Dey mad me be the amount of money them claim say them use to run the redesign mata. My people make we wise up. The goal of redesigning was for security reasons; most of you are missing the point of the entire project; this single act has rendered the pile of money stored for the political game next year useless; we now have the license to print our notes to save printing costs as well. Currency is not for fashion; the more colors you add, the more expensive it is to print; this is why most world currencies only have one color. If you are familiar with printing, you will know that work with more than one color is always very expensive to print. The new nots appears common, but it contains security details that you may not understand. the US dollar old currency and the new one is the same only few details were changed for security reasons.
|
|
|
|
Mr.right85
|
 |
November 25, 2022, 11:21:27 PM |
|
According to our leaders their intention no be to redesign per say , but say their intention na to bring out money wey people done hide, so that it will be in circulation, as me I see the color of money I was like what is this if that is truly their motive not bad at all because money wey people don hide no be small oh my brother so make we try look this thing for another dimension, and CBN have lifted all deposit charges so abeg if una get old money make we try carry them go bank.
I tink say dem bin wan go cashless b4. Abi no b part of d reason way bck mobile banking nd CBDC eNaira (e#) way dem bring... Hw will printing of new notes nd dat one carry join body? Hw e carry concern moni way pple hide abi d one way dey in circulation? Dat no b our wahala 4 dis nation. Dem knw watin b our wahala nd we kwa sabi watin dem sabi bt 4 common man to change somtin 4 dis we nation, e too hard. Where e bad reach be say, u ft tink say u dey die 4 somtin nd die 4 notin. D wayo way full we naija, no be watin one man ft solve nd so we go join hand 2geda mak we take 2023 election nd mak votes start 2 count 4 dis we nation.
|
|
|
|
Rruchi man
|
 |
November 25, 2022, 11:35:08 PM |
|
And when the redesign come out I also no too reason even if e Dey obvious that nothing much was done on the design but Wetin Dey mad me be the amount of money them claim say them use to run the redesign mata.
Please how much did the government say was spent on the project because I have searched the internet and I haven't seen a specific price that they claimed was used for this new currency redesigning. The news i only saw was that there is no official amount stated yet as what was used for the project , hence i dey surprised were you hear or see amount from wey you say wan mad you. Share link for us make we see where you get your information from.
|
|
|
|
Davidvictorson
|
 |
November 25, 2022, 11:35:47 PM |
|
This one na good development as along say na legit. Why I talk so na becasue say, I don too fill online forms wey we Naija government bring. I nor go fit forget N-Power and their nonsense batch selection abi na call up and at the end of the day nothing to show for am. But if this people really dey serious I go follow praise them because na good thing wey e be.
|
|
|
|
|